Cyber abuse of Alex Iwobi raise concern about safety of Nigerian players

Nigeria Super Eagles player Alex Iwobi

Getty Images

Days afta Nigeria lose di Afcon final to Cote D’ivoire, many super eagles fans don use social media to attack midfielder Alex Iwobi.

Di Fulham midfielder don receive plenty bashing since Sunday, wey force am to delete all im Instagram post.

Pipo tok say im be one of di reason why di super eagles lose di game.

Some of di fans start di troll and cyber attack for Twitter wia odas bash am for instagram.

Dem tok say di former Arsenal midfielder no deserve to be in di team.

Since den, many pipo don tok say di treatment of di midfielder wey always make dedicated to di national team dey unfair.

Alex Iwobi since im debut for di Super Eagles for October 2015, don make more dan seventy five appearances wia im score ten goals.

Di former Everton player since im debut, don dey among di squad for di 2018 World Cup, Afcon for 2019, 2021 and 2023.

Bifor den, im play for di England U-18.

For dis Afcon, di 27 year-old play a deeper role, wey affect im creativity.

Afta some of di fans criticize am after di round of 16 match, Iwobi explain why im creativity dey limited for dis games.

“Dem tell me say make I manage di ball and keep am for di team, na so I dey do.”

As journalists don ask why im create only three key passes for di first four games, Iwobi tok say “oda quality players dey in front of me wey dey do di job, Simon, Victor, Lookman.”

Im add say “I don dey do my job for di team, dat be why I dey here.”

Despite dis, some super eagles fans no gree give am.

Dem still pursue am for social media.

Captain Musa, Jay Jay, odas condemn cyber attacks on Iwobi

For one statement, di captain of di team Ahmed Musa tok say wetin some of di fans dey do, no fair.

“I want make di fans shun di cyber-bullying against Iwobi. Ibi violation of decency wia ibi serious crime.”

Di 31 year-old captain add say “to lose a game be tough, but to target one player for di team result dey unjust.”

“We win as a team, wia we lose as a team. Alex don give everitin on di field.”

Napoli and Bayer Leverkusen forwards Victor Osimhen and Victor Boniface as well as Afcon player of di tournament Williams Troost-Ekong don add dia voice.

Dem write for dia social media pages say “we win togeda, we lose togeda, we all be one. Some of our fans must do better.”

Oda players like Stanley Nwabali, Samuel Chukwueze, Joseph Aribo all don show dia support to Iwobi wey dem condemn cyber-bullying.

Former super eagles star and Iwobi im uncle, Jay Jay Okocha, also respond to di treatment.

Minister for sports, John Owan Enoh also condemn di attacks on di super eagles star afta di two don meet.

For one statement im tok say “you neva deserve wetin di fans dey do to you. You don represent di kontri for ova forty days, for di love of di game, wia you do your best.”

Di minister tok say im know wetin dey happun for social media wia as a ministry, “dis no be di first time we don dey condemn cyber bullying against our sports men and women.”

Oda players wey be victim of cyber bullying in di past

Alex Iwobi no be di only Super Eagles player wey pipo don bully am for social media.

Maduka Okoye be Nigerian goalkeeper wey don suffer trolls and attacks for social media during di 2021 Afcon for Cameroon.

Plenti fans bin blame di 24 year-old for di exit of di super eagles from dat Afcon.

Afta di attacks, tori be say na im consider leaving di national team.

Im deactivate im social media account for sometime but im return months later to support di national team.

Francis Uzoho be anoda player wey don suffer cyber bullying.

Di 25 year-old goalkeeper don dey chop attack since 2021.

Some fans don call am out sake of some goalkeeping errors im make.

Dem also blame am for di failure of Nigeria to qualify for di 2022 World Cup as di super eagles lose out to di black stars for di final qualifier.

Yakubu Aiyegbeni also suffer im own share of public criticism.

Di former Super Eagles and Everton player im big miss against South Korea for di 2010 World Cup be one wey many Nigerians neva dey forget.

Di former striker don receive backlash for dis, but unlike di odas wey crack under di pressure, im neva shake.

Wetin Nigerian law dey tok about cyber bullying

Dis attack don fall under crime for di cyber crime act 2015.

Di law prohibit wetin dem call cyber-stalking and cyber-bullying.

Di law prescribe punishment from fine of not less dan N2m or imprisonment of not less dan one year or both.

Di law also dey tok say pesin wey dey involve fit pay fine on not less dan N25 m or to jail of not less dan 10 years or both, depending on di severity of di offense.

For one statement from di Nigerian police force, dem remind pipo say to spread fake news and cyber bullying be crime wia dem dey go hard on pesin wey dey engage in dis tins.

Di force tok say dem “intensify effort to deal wit fake news and cyber bullying.”

Source