Who be Bolaji Agbede wey dey take over from Herbert Wigwe as Group CEO of Access Holdings

Access Holdings Plc don get new Group Chief Executive Officer.

Di pesin na Ms Bolaji Agbede wey go take di position in acting capacity.

Di board make di announcement on Monday – two days afta di death of Herbert Wigwe, di former Group CEO of di bank.

Oga Wigwe bin die for helicopter crash on Friday night.

Di helicopter crash also claim di lives of di former Access Holdings Group Chief Executive Officer wife, son and two oda crew members.

National Transport Safety Board (NTSB) for one briefing on Sunday on top di helicopter accident tok say, di Airbus Helicopters EC-130 crash for California near di Nevada border.

NTBS say dia investigation on top di helicopter accident on Sunday tok say di Airbus Helicopters EC-130 crash for California near di Nevada border.

One NTSB board member, Michael Graham and one investigator, Aaron Sours wey dey in charge of di incident bin provide details on di helicopter wey crash.

Dem tok say witness reports suggest say rain dey fall wen di helicopter crash.

“Witness reports to di weather condition at di time of di accident suggest rain plus wintry mix.”

While pipo dey mourn di Board of Directors of Access Holdings Plc afta dia statement wey confam di death of dia Herbert Wigwe, announce Ms Agbede as di Acting Group Chief Executive Officer.

“Di appointment dey subject to di approval of di Central Bank of Nigeria”, di company tok for statement wey di Secretary Sunday Ekwochi sign.

Who is Bolaji Agbede

Ms Agbede wey be di most senior founding Executive Director in charge of Business Support for di company go take over di leadership of di company afta CBN confam am.

Di change mark ogbonge point for di company history wey go try manage di situation afta di sudden death of Wigwe.

  • Ms Agbede get up to 30 years of professional background for banking and business consultancy services.
  • She start her professional career for Guaranty Trust Bank for 1992 wia she serve for different position including Relationship Manager and Vault Custodian, according to her profile for Access Bank.
  • She climb from di grade of Executive Trainee in 1992 to Manager in 2001.
  • Ms Agbede den serve as di Chief Executive Officer of JKG limited for 2003.
  • She join Access Bank in 2003 as Assistant General Manager wey her work na to manage di Bank portfolio of chemical trading companies.
  • She later occupy di role of Head, HR for Access Bank Group since 2010 wia she dey in charge of human capital development of di Group.
  • She finally climb to di role of Access Holdings Plc founding Executive Director, Business Support, wia she play ogbonge role for di successful integration of business units and di transformation of di company culture.

Bolaji Agbede get Bachelor’s Degree in Mathematics and Statistics from di University of Lagos in 1990.

She get Master of Business Administration Degree from Cranfield University for UK in 2002.

She be member of di Chartered Institute of Management UK and di Chartered Institute of Personnel Management of Nigeria.

Ms Agbede don also attend plenty leadership and professional development programmes including di High-Performance Leadership Programme wey IMD and di Strategic Talent Management Programme of di London Business School organise.

NSIB collabo wit NTSB to torchlight helicopter accident

Di Nigerian Safety Investigation Bureau (NSIB) don announce say dem don begin collabo wit di America goment to step up investigation on di helicopter accident wey cause di death of Herbert Wigwe plus five odas.

One tok-tok pesin for NSIB, Bimbo Oladeji, announce dis informate for inside statement on Monday.

Wigwe, wey until im death na di Group Chief Executive Officer of Access Holdings, im wife, son, former Group Chairman of di Nigerian Exchange Group Plc, Abimbola Ogunbajo and some odas bin dey onboard di helicopter wey crash on 9 February.

Oladeji tok say afta di accident, NSIB oga, Captain Alex Badeh bin establish contact wit NTSB, in accordance wit Chapter 5 subsection 27 of ICAO Annex 13 to di Convention on International Civil Aviation – Aircraft Accident and Incident Investigation, wey grant a kontri special interest for accident wey involve dia citizens.

Already, tok-tok don start between di NSIB and di US NTSB according to di Nigerian goment.

Oga Badeh add say di accident na big loss to Nigeria.

“In tandem, di operations investigation group don begin gada important about di company wey include pilot records, flight dispatch records, and aircraft maintenance records.” Di statement tok.

Isiokpo Ancient Kingdom declare 8-day mourning period

Meanwhile, Isiokpo Kingdom traditional council don declare eight days mourning period for di CEO of Access Holdings and founder of Wigwe University, Isiokpo, Herbert Wigwe.

His Royal Majesty, King Blessing A N Wagor JP, Wagidi XL declare di mourning period for inside statement.

E say di eight-day mourning period go start on Wednesday, 14 February to 21 February.

“All shops, markets and oda forms of business activities go remain totally closed on di first day from 8am to 4pm and mourners go gada for Isiokpo round about for procession to his majesty palace while business activities go dey low key for di oda days.”

Di King also say make all sons and daughters of Isiokpo Ancient Kingdom, for home and abroad to tie black hand band during di mourning period in honor of di business mogul.

Dangote, Abiodun, Aig-Imoukhuede, Peterside, odas visit Wigwe parents

Ogun state govnor, Dapo Abiodun, Nigeria businessman and Industrialist, Aliko Dangote plus a group of close friends and associates bin pay condolence visit to di aged parents of di late business mogul, Herbert Wigwe.

Oga Abiodun for im Facebook page, tok say dem gada to express dia heartfelt condolences give Pastor Shyngle Wigwe and Mrs Stella Wigwe.

“These sorrowful parents don suffer di loss of dia beloved sons, Herbert Wigwe, Mrs Chizoba , and im son Chizi for one tragic helicopter accident,” e post.

Source