‘We study hard and we no deserve dis suspension’ – Nigerian students for Benin Republic share dia concerns

Fotos of students from Benin Republic

BBC

Some Nigerian students for di Republic of Benin don tok say di federal goment suspension of di evaluation and accreditation of degree certificates from schools in dat kontri and Togo no be di correct solution to tackle certificate buying.

But, dem dey call for investigation so goment go fit determine di universities wey dey sell certificates so odas no go dey suffer di crime of some criminals.

One mass communication student from Estam University Benin Republic wey follow BBC Pidgin tok, Alberty Oluwatoyosi say e dey pain am say all universities and students for Benin Republic go suffer for crime wey dem bin no commit.

Di student explain say dem pay di price to be students as dem dey burn dia candle for night so dem go fit read and dem no deserve di suspensions.

Oluwatoyosi say she bin no worry about job for future becos she dey certain say beyond her certificate her brain go fit help am for future.

She say goment suspension no be di way forward instead make dem investigate di mata.

“I dey about NYSC becos my parents want make I serve my kontri but since goment don suspend am di possibility dey veri slim but I dey hope say dem go lift di suspension soon.

“No be new tin say institutions dey sell certificates and no be only institutions for Benin Republic dey do am even universities for Nigeria dey guilty of dis act,” Toyosi tok.

She say make authorities investigate all institutions for Benin Republic and Togo so evribodi no go suffer for di crime of some pipo.

Anoda student wey dey department of theatre art for Republic of Benin, Akerele Olawale, tok say im dey worry say di suspension go affect im NYSC deployment becos if e no serve di kontri e no fit get beta job.

Olawale add say if NYSC no accredit im university or students from Benin Republic e no fit serve and e dey affect im mental health.

“My mental health dey affected, I just dey tink about how I fit get beta job and serve. I dey really worried about di situation,” Olawale tok.

“I neva witness certificate buying and my institution no dey do am. I no sabi anybodi wey don do am bifor.”

Teacher dey teach students for one univerity for  Abidjan

Getty Images

Why Nigerian goment suspend accreditation of degree certificates from Benin Republic and Togo

Nigeria goment don suspend di evaluation and accreditation of degree certificates from Republic of Benin and Togo.

Di Ministry of Education for Nigeria announce di suspension inside statement wey dem release on Tuesday 2 January, 2024.

Na di Acting Director Press and Public Relations, Augustina Obilor-Duru sign di statement wia dem say di suspension dey necessary afta one investigative journalist torchlight how pipo dey allegedly get university degree certificates wey suppose take 4 years to get, but dem dey get am in six weeks from dis kontris.

“Di publication by di Daily Nigerian Newspaper on 30th December 2023 titled “UNDERCOVER: How DAILY NIGERIAN reporter bagged Cotonou varsity degree in 6 weeks, participated in NYSC scheme”.

Dis report confam di suspicions say some Nigerians dey use mago-mago means and methods to get a Degree wit di end objective of getting graduate job opportunities wey dem no qualify for, “ di ministry tok.

Wen di suspension go start?

According to di Ministry of Education for Nigeria wey dey para well well say dis kain tin dey happun, dem say di suspension go start immediately from Tuesday 2 January, 2024

“Di Federal Ministry of Education wit effect from 2nd January 2024 go suspend evaluation and accreditation of degree certificates from Benin and Togo Republics depending on di outcome of one investigation wey go involve di Ministry of Foreign Affairs of Nigeria and di two kontris.

“Di ministries wey dey responsible for Education for di two kontris as well as di Department of State Security Services (DSSS), and di National Youths Service Corps (NYSC).”

Di Ministry tell di General Public to support dis efforts, show understanding and provide useful information wey go assist di Committee to find lasting solutions so dat dem go stop am make e no happun again.

Di Ministry say dem don start internal administrative process to determine di pipo wey get hand inside or otherwise, including dia staff and dem go apply Public Service Rules.

Nigeria goment say di issue of degree mills institutions, (institutions wey dey exist on paper or wey dey operate anyhow outside di control of regulators na global problem wey kontris dey battle wit.

Dem add say Nigeria goment don dey fight dis problem since, including illegal institutions wey dey abroad or at home wey dey take advantage of unsuspecting, innocent Nigerians and some desperate Nigerians wey dey deliberately patronise dem.

Dem explain say from time to time di Ministry and National Universities Commission dey give warnings against dis mago-mago institutions and dem go continue to review dia strategy to plug any loopholes, processes and procedures and deal decisively wit any official wey dey do collabo wit dem.

Pipo wey wan serve go dey affected?

Concerning pipo wey don already graduate from universities from dis kontris wey wan go Nationl Youth Service Corps, dis suspension go affect dem? Na di question BBC Pidgin ask tok-tok pesin for di Ministry of Education, Benjamin Gong.

Im tell BBC Pidgin say “Di Ministry of Education get committee wey dey handle pipo wey don graduate wey wan do NYSC, di committee go chook-eye well well to check properly if dem get any requests for NYSC as dis ban don dey in place.

For pipo wey don already use dis type of mago-mago certificate get work, Gong tok say e dey for Nigerian law say anybodi wey im employers find out say e use fake certificate get any work dem go sack am.

“Di law apply for evriwia, weda you bring di certificate from abroad or or you get am for inside Nigeria so far say na fake, di law say you go lose your job.

Gong add say wetin Nigerian students dey do no correct as far as international studies dey concerned.

Im say, ” Before any student apply for any foreign school dem suppose come di Ministry of Education to verify if di school dey authentic, if dem get accreditation, if dem dey do di courses dem wan study, but dem go apply school finish, wait until time for NYSC before dem go come di Ministry.”

Source