Biden and Harris inauguration live: Watch Joe Biden, Kamala Harris US Presidential inauguration ceremony live

[Where to watch the inauguration?] Watch inauguration of Joe Biden here:

https://www.facebook.com/watch/live/?v=239547194407498&ref=watch_permalink

Joe Biden inauguration live on Wednesday reach peak as im take oath of office as di 46th President of United State at about 11:48am ET (16:48 GMT) on Wednesday 20 January, 2021.

Donald Trump no show face for di inauguration but im don leave White House for di final time of him presidency.

Inauguration live stream: Joe Biden [President of United States], Kamala Harris inauguration ceremony live

Getty Images

Joe Biden take di oath of office inside US Capitol Hill, Washington, wey don dey protected alias fortified following a deadly riot wey happun for Capitol dis month.

Joe Biden inauguration live stream: Watch Biden inauguration ceremony[where to watch the inauguration day 2021]

Reuters
Joe Biden and im wife Jill arrive di stage

Alongside oga Biden, Kamala Harris make history wen she take oath alias sworn in as di nation [US] first woman vice-president.

Joe Biden inauguration live stream: Watch Biden inauguration ceremony[where to watch the inauguration day 2021]

Getty Images
Kamala Harris as she arrive

Some 25,000 troops go guard di inauguration ceremony, wey go miss di traditional hundreds of thousands of viewers alias spectators due to di coronavirus pandemic.

Senator Amy Klobuchar, di oga of di inauguration planning na im start di proceedings.

Lady Gaga na im sing di national anthem for di ceremony after di opening prayers.

Inauguration of Joe Biden [where to watch the inauguration day 2021]:

Reuters

But Vice President Mike Pence and im wife sho face live for di inauguration,

Some former Presidents and former Vice Presidents show face for di inauguration.

House Speaker Nancy Pelosi dey attend di event.

Jennifer Lopez sing “Dis Land” rendition during di ceremony.

Oga Trump don take helicopter to di nearby Andrews base, where he im go speak and then board di Air Force One plane for Florida.

Trump leaves the White House for the last time as US president
The British Broadcasting Corporation

Im be di first president to snub im successor’s inauguration since 1869.