Russia sanctions 2022 list: Sanction imposed on Russia over Ukraine invasion, wetin e mean and Putin response

putin

Reuters

Measures wey dey designed to damage di Russian economy following im invasion of Ukraine don dey introduced by di US, UK and EU, among odas.

In response, Russia don ban di export of some products.

Wetin be sanction?

Sanction na penalty wey one kontri sama anoda most times in order to stop am from acting anyhow or breaking international law.

Sanctions most times dey designed to di kontri economy, or di finance of individual citizens like top politicians. Dem fit include travel bans and embargo on arms.

Except to go war, sanctions dey among di strongest measures nations fit use.

Which sanctions dem don impose on Russia?

US dey ban all Russian oil and gas imports and di UK go phase out Russian oil by di end of 2022.

US President Joe Biden say e dey target “di koko of wetin dey run of Russia economy”.

EU, wey dey get a quarter of im oil and 40% of im gas from Russia, say e go switch to alternative supplies and make Europe independent from Russian energy “well before 2030”.

Germany don put on hold permission for di Nord Stream 2 gas pipeline from Russia to open.

Why Russia dey invade Ukraine?
The British Broadcasting Corporation

Financial measures

Western kontries don freeze di assets of Russia central bank, to stop am from using im $630bn (£470bn) of dollar reserves. Oda measures against am include:

Suspension from di Bank for International Settlements – “di central bank for central banks” – to stop am from using im services

Di US, EU and UK don ban pipo and businesses from dealings with am.

Some Russian banks don dey removed from di international financial messaging system Swift, wey dem dey use to transfer money across borders. Dis one go include delay payments to Russia for energy exports.

One worker wka pass one output filtration facility of gas treatment unit for di starting point of di Nord Stream 2 offshore natural gas pipeline

Getty Images
Germany don block di Nord Stream 2 pipeline from Russia from coming into operation

Other UK sanctions include:

major Russian banks dey excluded from di UK financial system

all Russian banks assets go dey frozen

di Russian state and major companies no go dey able to raise finance or borrow money for di UK

dem go place a limit on deposits Russians fit make for UK banks

EU also say dem go target 70% of di Russian banking market and key state-owned firms.

SWIFT logo displayed on a phone screen and American flag displayed in the background

Getty Images
Both US and Germany have voiced doubts and asked if the cost to cut off Russia from SWIFT would be too high.

Targeting individuals

Dem don impose sanctions on wealthy business leaders known as oligarchs, who dey considered to be close to di Kremlin.

UK don sanction seven Russian billionaires, including Chelsea FC owner Roman Abramovich. Dem don freeze dia assets and restrict dia ability to travel.

E don also impose sanctions on 386 members of di Russian parliament, in line with action wey don already dey taken by di EU and US.

Roman Abrahamovic bin dey try to sell Chelsea FC

PA Media

Dem don freeze assets wey belong to Russian President Vladimir Putin and im foreign minister Sergei Lavrov for di US, EU, UK and Canada.

UK dey limit di sale of “golden visas”, wey dey allow wealthy Russians to get British residency rights.

Trade with Russia and travel

Restrictions on which products dem fit send to Russia don dey announced by di UK, EU, US and odas.

Dem include dual-use goods – items wey fit serve both civilian and military purpose – including chemicals and lasers.

EU wan to make am impossible for Russia to upgrade im oil refineries. Dem dey also ban di sale of aircraft and equipment to Russian airlines.

All Russian flights don dey banned from US, UK, EU and Canadian airspace. Di UK don also ban private jets wey dey chartered by Russians.

City of London

Getty Images
UK goment don vow to fight illegal Russian money flow into London.

Wetin companies dey do?

A number of international companies wey include McDonald’s, Coca-Cola and Starbucks don suspend trading for Russia.

Firms don act because shareholders “no go stand” for di continued generation of profits from Russia, according to Anna MacDonald, fund manager for Amati Global Investors.

How Russia don react to di sanctions?

Russia don ban exports of more dan 200 products until di end of 2022.

E include telecoms, medical, vehicle, agricultural, electrical equipment and timber.

Dem don also more dan double dia key interest rate to try to stop di fall of di Russian rouble.

In addition, dem dey block interest payments to foreign investors wey hold goment bonds, and dem dey ban Russian firms from paying overseas shareholders.

Russia don stop foreign investors wey hold billions of dollars worth of Russian stocks and bonds from selling dem.

Russia do also warn say dem fit shut off gas supplies in response to oil sanctions.