How Premier League break summer spending record wey reach £2.36bn on Transfer deadline day

PL

BBC Sport
Dominik Szoboszlai, Moises Caicedo and Declan Rice dey among players wey move to clubs during di summer transfer window

Di transfer window don finally end on Friday, and Premier League break anoda record.

Dis na afta clubs spend £2.36bn ontop new players.

Di combined outlay of di 20 clubs during di window over take di former spending record of £1.92bn set last summer by £440m, according to financial services firm Deloitte.

Premier League clubs spend £255m on deadline day alone, wey dey more dan double di £120m dem spend on di final day of last summer window.

E mean say di 2023-24 season already get di second-highest transfer spending ever afta last season £2.73bn – and January window go still come.

Oda records wey Premier League set

Di Premier League no dull for dis transfer window at all as dem account for 48% of total spending across di ‘big five’ European leagues – La Liga, Serie A, Bundesliga and Ligue 1.

Premier League clubs collect £550m for transfer fees from overseas clubs, more dan double of di record of £210m for di 2022 summer.

Wit di exception of Spain La Liga, gross transfer spend increase for all of Europe ‘big five’ leagues

Only two of Europe ‘big five’ leagues spend more on transfers dan wetin dem collect – di Premier League and Ligue 1

Thirteen Premier League transfers dey valued at £50m-plus, wey dey more dan di previous two summer transfer windows join togeda.

Tim Bridge, lead partner for Deloitte Sports Business Group, say: “A second back to back summer of record spending by Premier League clubs suggest say year-on-year revenue growth fit return following di pandemic.

“Nearly three-quarters of Premier League clubs (14) spend more dis summer dan di last, wey show di increased intensity of competition.

“Pressure continue to dey on clubs to buy beta talent to satisfy dia on-pitch objectives, weda na to qualify for European competition or just to maintain dia position for di Premier League.”

Deals wey happun on deadline day

Premier League deals

Getty Images
Matheus Nunes, Brennan Johnson, Ansu Fati and Ryan Gravenberch make moves on deadline day

For di biggest Premier League deal of deadline day, Manchester City sign Portugal midfielder Matheus Nunes from Wolves for £55m.

Di Treble winners sell Cole Palmer to Chelsea for £40m.

Manchester United buy goalkeeper Altay Bayindir from Fenerbahce for £4.5m, midfielder Sofyan Amrabat go on loan from Fiorentina, full back Sergio Reguilon go on loan from Tottenham and free agent Jonny Evans get one-year deal.

Nottingham Forest na di club wey busy pass, dem sign seven players including midfielder Ibrahim Sangare from PSV, winger Callum Hudson-Odoi from Chelsea and midfielder Nicolas Dominguez from Bologna.

Oda notable deadline day deals include:

Ryan Gravenberch move from Bayern Munich to Liverpool for £34.3m

Ansu Fati from Barcelona to Brighton on loan

Brennan Johnson from Nottingham Forest to Tottenham for £45m

Alex Iwobi from Everton to Fulham for £22m

Clement Lenglet from Barcelona to Aston Villa on loan

Albert Sambi Lokonga from Arsenal to Luton on loan

Mason Greenwood from Manchester United to Getafe on loan

Rob Holding from Arsenal to Crystal Palace for £4m

Luis Sinisterra from Leeds to Bournemouth on loan.

Di big transfers of di summer?

Big transfers for PL

Getty Images

E get two transfers wey hit di £100m mark dis summer. Chelsea sign midfielder Moises Caicedo from Brighton for £100m fee wey fit rise to a British club record of £115m.

Arsenal buy England midfielder Declan Rice from West Ham for £100m plus £5m in add-ons.

Along wit deadline day signing Nunes, Manchester City buy defender Josko Gvardiol for £77m from RB Leipzig, winger Jeremy Doku from Rennes for £55.4m and midfielder Mateo Kovacic, wey come for £25m from Chelsea.

Manchester United sign Denmark striker Rasmus Hojlund for £72m, while fellow Champions League side Newcastle United buy Italy midfielder Sandro Tonali for £55m and Leicester forward Harvey Barnes for £38m.

As well as Rice, last year Premier League runners-up Arsenal add Kai Havertz from Chelsea for £65m and Ajax defender Jurrien Timber for £34m.

Liverpool strengthen dia midfield wit moves for Dominik Szoboszlai from RB Leipzig for £60m, Alexis Mac Allister from Brighton for £35m and Wataru Endo from Stuttgart for £16.2m.

Best deals from around Europe

Best deals in Europe

Getty Images
Jude Bellingham and Harry Kane make high profile moves for Europe dis summer

Two of di biggest transfers for Europe dis summer involve England players.

Three Lions captain Harry Kane join Bayern Munich from Tottenham for £86.4m, while midfielder Jude Bellingham join Real Madrid from Borussia Dortmund for £88.5m.

Barcelona sign Ilkay Gundogan on a free transfer afta di midfielder comot from Manchester City.

Dis na before im seal deadline-day loan moves for City defender Joao Cancelo and Spain forward Joao Felix from Atletico Madrid.

Di most expensive deal of deadline day na Paris St-Germain wey buy France striker Randal Kolo Muani from Eintracht Frankfurt for £64.2m plus £12.8m in add-ons.

Chelsea top spending league

Chelsea spend money

Getty Images
Romeo Lavia, Cole Palmer and Axel Disasi dey among di players to join Chelsea dis summer

Dis na Chelsea third transfer window under new owner Todd Boehly and dia spending no show any sign say dem go slow down soon.

Di London club spend more dan £380m ontop 10 players for dis transfer window, more dan any oda side for Europe.

Di highest summer spending by any club for di world before now na Real Madrid £292m spree for 2019.

Chelsea outlay on players across three transfer windows since Boehly took charge don dey close to £1bn.

Dia spending dis summer don take style balance, afta dem sell some of dia ‘big’, nine players comot from di club on permanent deals, including Havertz to Arsenal and Mason Mount to Manchester United for an initial £55m.

Saudi Arabia dey show say dem get money

Di Saudi Pro League spend plenti money on ogbonge global stars, including Neymar and Karim Benzema.

Dis na as di Saudi authorities dey push to make di league one of di most competitive for di world.

Saudi Arabia Public Investment Fund recently take over four of dis top teams for di kontri – Al-Ittihad, Al-Nassr, Al-Hilal and Al-Ahli – while di oda 14 top-flight clubs still get some big-name players too.

According to Deloitte, Saudi Pro League clubs don spend £690.55m (805m Euros), so far, dem spend £245m of di money on Premier League players.

E make di league di fourth-highest spender for di world dis summer, behind di Premier League, Ligue 1 and Serie A.

And more big-money moves fit dey too, wit di Saudi transfer window wey still dey open until 7 September – and Al-Ittihad wey Liverpool bin reject dia £150m.

“Di emergence of more active participants for di global transfer market get di potential to push clubs’ efforts to establish financially sustainable business models,” Calum Ross wey be assistant director for Deloitte’s Sports Business Group tok.

“For dis summer transfer window, clubs wey don sell players to di pipo from international leagues wey dey come up, don go on to spend receipts wit a large number of oda clubs, both inside and outside of di Premier League.

“Dis distribution of di new flow of funds into di market na key to make sure say di financial benefits of a more active global market dey enjoyed across di board, serving to reduce rather dan widen any existing gaps.”

Some of di notable departures from di Premier League for Saudi Arabia include Newcastle winger Allan Saint-Maximin and Manchester City’s Riyad Mahrez joining Al-Ahli, Wolves captain Ruben Neves moving to Al-Hilal, Manchester City defender Aymeric Laporte joining Al-Nassr and Liverpool captain Jordan Henderson moving to Al-Ettifaq.

Di deals wey no work

Even though clubs don spend millions of pounds for di transfer window, some deals still dey wey no work out.

PSG bin give Saudi Arabian side Al-Hilal permission to tok to Kylian Mbappe afta dem make a world-record £259m bid, but di striker no gree go , im stay wit di French champions – while Liverpool reject Al-Ittihad’s £150m offer for Salah.

Joao Palhinha bin agree terms wit Bayern Munich and even fly to Germany to do medical on deadline day, but Fulham no fit strike deal wit di Bundesliga champions and di move collapse.

Source