‘Why I dey put my feem for YouTube’ – Ruth Kadiri

‘Why I dey put my feem for YouTube’ – Ruth Kadiri
The British Broadcasting Corporation

Ogbonge Nigerian actor, producer and screenwriter, Ruth Kadiri don tok why she begin put her feems on YouTube.

Di star wey get 2 million subscribers on YouTube, wey also be one of di Nollywood feem makers wey front di trend, tok say na sake of di plenty rules and regulations wey dey feem production for Nigeria.

Also, di social media platform na space wey allow her fit express herself freely and tell her stories.

Most Nigerian feem makers, actors and content creators now don dey put dia contents on YouTube since dia eye open to di moni and oda opportunities wey dem fit benefit from di social media platform.

Nollywood na di third largest feem industry for di world – afta Hollywood and India Bollywood.

Dem dey produce more dan 2,500 feems a year.

Ms Kadiri tell BBC News Pidgin say if no be YouTube moni, plenty Nollywood creatives for broke well-well.

“Na opportunity for lot of feem makers to make moni and na wetin dey happun now, becos na YouTube dey feed pipo now.”

She however beg her colleagues plus oda content creators say make dem no spoil d I platform for her and odas.

Di actor don produce plenty movies wey get hundreds of thousands of views on YouTube.

Sake of her busy career, Ms Kadiri say she no dey allow her work affect her family as e get way she take dey arrange evritin wey work no go affect her family.

Above all, she get understanding spouse wey two of dem understand each oda well-well, di actress too.

Source