Netherlands and France play out scoreless draw in high pressure Euro Group D fixture

France and Netherland player go for di ball

Getty Images

Netherlands and France play out scoreless draw in high pressure Euro Group D fixture on Friday night.

France get many chances to score for di game wia dem dominate in terms of possession and goal attempts.

But in di end, both teams go share di point.

France get di early chances to score wit Griezmann and Adrien Rabiot both missing di goal bifor di Dutch come enta di game wit dia own chances.

Di biggest toking point na French captain Mbappe im nose injury – di Real Madrid player no get chance to play dis game as im dey on di bench wit im protective mask.

Na so Xavi Simmons tink say im grab di opening goal afta di 70th minute but VAR don tok say Dumfries dey interfere wit play from an offside position.

Afta dat chance, France now pile pressure but dem no fit to breach di Dutch defence despite say dem get chances through Dembele, Griezmann, Adrien Rabiot and substitutes Kingsley Koeman and Olivier Giroud, di record scorer for France.

In di end, both teams get to settle for a point wey dey mean say di final group games go decide which team go finish di group as winners.

For now, Netherlands dey top of di table wit 4 points same points as France wey dey second. Austria wey win dia match against Poland (3-1) dey third wit 3 points and Poland dey bottom of di table wit zero points.

Second Half

FULLTIME!

95″ Netherlands defender shepherd di ball for goalkick, Dat go be di end. Referee blow whistle and dis game end 0-0. Di first scoreless draw so far for dis tournament.

94″ Be like both teams go happy wit one point from dis pressure game. But maybe one last chance go dey.

93″ Netherlands try to enta di French area but dia cross don hit Kounde wey e go throw.

92″ Netherlands finally fit breathe as dem win freekick for midfield but France don dey pressure dem to win di ball.

91″ France just dey try find dat one chance inside di Dutch box but di Netherlands defenders dey cova dia back well well.

90″ Wout Weghoust wey be striker don enta im box to defend one chance as Kante dey try shoot on goal.

90″ 5 added on minutes for dis game. Any chance for late drama? Make we dey watch am

89″ Di last five minutes na France don dey pepper di Dutch area.

88″ Di Juventus man get great chance inside di box, instead say im go shoot, im decide to cut di ball to Koeman, na so di chance miss!

87″ Adrien Rabiot don injure wey im receive treatment bifor ref restart di game.

86″ CHANCE! Giroud head di ball back for im teammate to strike on goal but di Dutch defence crowd di area and di chance don vanish.

85″ Netherlands finally get di ball, but di long pass ova di top for Dumfries don dey too hard.

84″ Patient build up by France – Koeman, rabiot, Griezmann all dey pass di ball around in front of di Dutch area.

83″ France dey begin to pile peressure on top dis Dutch midfield and defence. Di moment dem get di ball, dem go hassle dem till dey lose di ball.

81″ Long ball for Giroud inside di area but im no fit to connect.

79″ Kante tink say im for get freekick as im dey drive into di Dutch area but referee say play on. Di subsequent ball by Georginio Wijnaldum into di channel for Weghoust dey too strong.

78″ From di corner, linesman don catch Weghoust say im dey offside.

78″ Di freekick na di last tin Depay go do bifor Wout Werghoust go replace am.

77″ Depay take di freekick into di area to find Van Dijk but Hernandez don head di ball for corner.

76″ Georginio Wijnaldum don win freekick as Kante hack di sub down in front of di french box. Memphis Depay go take di freekick.

75″ Kingsley Koeman and Olivier Giroud don enta for France to replace Dembele and Marcus Thuram. Still no Mbappe yet.

Lutsharel Geertruida, Joey Veerman and Georginio Wijnaldum enta di game now for Netherlands.

71″ Dat offside goal be di last action for Xavi Simmons. Koeman don sub am den Frimpong.

70″ Afta long VAR check, di goal no go stand. Officials say na offside.

69″ Xavi Simmons tink say im score di first goal of di game but referee say offside. VAR dey check if Dumfries dey interfere for di play

68″ Afta dat chance, Netherlands break forward and grab a goal.

67″ CHAAAAANCE! Dembele again! Di PSG man dey get plenti joy inside di Dutch area, but afta im take on one, two defenders wit im skill, im shoot ova di bar!

66″ From di corner, France attack again but Maignan pick up di ball. Netherlands go fit to breathe small.

64″ CHAAAAAANCE! Anoda big miss by France. Tchouameni, Kante, Rabiot all pass pass di ball nicely into di box bifor di ball meet Griezmann but instead say im go shoot am first time, im take one touch wey im subsequent shot dey weak.

63″ France dey on top now wit plenti of di ball and plenti chances but dem neva fit tio find di goal yet.

62″ Netherlands tink say dem clear di danger but Dembele cross di ball inside di box but Tchouameni im header go ova di bar.

61″ Dembele don win corner off Nathan Ake wit some fine skill but di PSG man im corner no trouble di Dutch defense.

60″ Xavi Simmons sit for floor afta tackle from Tchoumeni. Di Liepzig player now sleep on top di ball until di ref blow whistle for freekick for France.

59″ Tins don begin dey settle – but Thuram try to find some space inside di box to shoot under pressure from Dumfries. Di effort go wide.

57″ Depay and Thuram both lose possession under one minute bifor Kante break away to di left of attack bifor Tchouameni blast one shot into di stands!

56″ Chance for France but Adrien Rabiot blast im shot from inside di box, wide.

55″ OFFSIDE! Linesman don raise flag as Depay dey offside.

55″ Di ball still dey dance around di Dutch area but Frimpong delay on top di ball wey im conceded goalkick.

54″ Depay dey stand behind di freekick but im shot hit di wall.

53″ Netherlands dey slowly build up into di French area but dem no get clear cut chance until Xavi Simmons try to enta di box wey im win foul from Dembele. Dangerous area.

52″ From di restart, France get chance of dia own but Kante wey dey play club football for Saudi Arabia blast one shot into row z!

51″ Upamecano don put pressure for di Dutch forward wey enta dia box wey im hit di ball wide.

50″ Di ball break to France wia Dembele take one touch to beat im defender, bifor im hit a shot but di Dutch defenders block am.

49″ Frimpong don foul Hernandez for di French defender im area.

48″ Some players dey already do warm up on di sidelines. We fit to see some early subs.

46″ Early chance for France as Dembele race into di area – Nathan Ake don dey chase am, but both players no fit to reach di ball bifor im go over for goalkick.

46″ No changes to both teams as Mbappe remain on di bench.

45″ Di second half don begin

Whichever team win dis game now go dey on top of di group.

Austria wit dia 3-1 win ova Poland dey third for di group – Poland dey without a point afta two games.

Both teams don return to di pitch – dia coaches go dey hope say di halftime team tok go show for di park as dem go try to find goals.

First Half

HT Netherlands 0 – 0 France

46″ France dey string dia passes for midfield as Kante try to sprint away, di ref don blow whistle for halftime.

45″ Dem go play only one minute additional time.

44″ France don win freekick inside di Dutch area afta Ake sleep on top of di ball. No danger fit comot dat freekick from dat side and France now begin to dey pass pass di ball for dia area.

42″ As half time don dey approach, both teams dey try to get di advantage. Griezmann don head one Hernandez cross into di hands of di keeper.

40″ Griezmann im freekick take defection off Van Dijk for corner – Gakpo don head dat ball go throw.

39″ Dembele win freekick inside a dangerous area as Van Dijk cot di PSG winger right in front of dia box. Two freekicks for dangerous area in one minute.

38″ Griezmann take di freekick but Van Dijk head am away only for Upamecano to concede throw ball for di Dutch area.

37″ Chance break for France but De Vrij don hack down Thuram for freekick not far from di Dutch box.

36″ Di game dey end-to-end now as both teams dey attack dia opponent di moment dem get di ball.

35″ Xavi Simmons now get chance to run at di French defence – but im shot dey weak; Maignan collect am simple.

34″ Frimpong from Netherlands win possession inside di midfield wia im try attack enta di box. Di Leverkusen man now hit di shot against a defender.

34″ Gakpo run enta di France box but im no fit collect one fine ball ova di top.

33″ Gakpo come defend one dangerous attack by France wey im pass to Simmons to begin anoda attack but di French players recover quickly.

32″ Memphis Depay try to begin di counter afta France lose di ball inside midfield but Depay lose di ball also – Frimpong try to recover di ball but Griezmann dey strong to keep possession.

31″ First yellow card of di game as Schouten foul Griezmann on di break.

30″ Netherlands allow France to come forward again but di pass to Thuram dey weak.

29″ Griezmann win foul against Dumfries for di middle. But France lose di ball immediately afta dem take di freekick.

27″ CHAAANCE! Thuram pick one long pass wia im alone run enta di Dutch area, but im blast di ball wide from a tight angle.

25″ Netherlands burst forward on di break wit Frimpong – im pass di ball to Gakpo. Di Liverpool man try to beat two pipo bifor im play di pass behind Depay. Dat chance don vanish!

25″ France get 57% of di possession so far for dis game but dem neva take dia chances

24″ Depay now turn di offender as im hack one French player for dia area for foul.

23″ Depay blast one freekick into di area, but Dumfries im header go wide.

22″ Di last few seconds – di game don turn scruffy wit both teams committing small small fouls hia and dia.

21″ Kounde don intercept one long cross wey im head am back to im keeper.

20″ Adrien Rabiot blast one cross over di ball from di left hand side afta Kante spread di ball to am.

19″ France still dey push for di Dutch area, but Kante im pass in front of di box dey intercepted – Netherlands try to begin dia own attack but dem lose di ball.

17″ Corner for France, as Dumfries clear di ball. But di corner neva trouble di Dutch as di ball eventually go throw. Ake go take dat throw.

16″ CHAAANCE for Netherlands. Di Dutch pour forward wit Gakpo – as im enta di box, di Liverpool man beat two defenders bifor bending a shot. But goalkeeper Maignan don save di ball.

14″ Seconds afta dat chance, France pounce again but dis time Griezmann im shot go wide ova di bar.

13″ CHAAAANCE! Big, big chance wey France don miss. Di ball don come to Rabiot, wia instead say im go shoot inside goal, im try to pass to Griezmann, but di Atletico man don slip wia di chance vanish.

12″ Patient build-up from France almost lead to one chance for Griezmann, but di Dutch defender clear di cross bifor di ball go fit land on top Griezmann im head.

11″ Now Netherlands dey pass di ball for dia area as dey prepare to launch anoda attack, but Saliba don win freekick for France.

10″ Kante hack down Xavi Simmons – di Dutch take di freekick quickly, but again, di French defence dey alert.

9″ Griezmann don win foul in im own area – chance for France to begin dia build up again.

8″ Depay dey shout to di referee for penalty afta Saliba prevent am from turning inside di box. No penalty!

7″ Rabiot no fit to keep di ball for di park afta one crossfield pass.

5″ Both teams now begin to dey pass di ball to settle for dis game.

4″ From di corner, Netherlands don begin to attack thru Xavi Simmons, but Kounde defend dat ball well well.

3″ France get dia own chance afta rabiot pass di ball to Griezmann. Di Atletico Madrid striker hit di shot wia di Dutch keeper punch am ova di bar.

2″ Di corner don cause sakala inside di penalty area but referee blow whistle for one foul. France fit to breathe small.

1″ CHAAAANCE! Netherlands almost score wit dia first chance as Jeremy Frimpong break for dia yard. Di Leverkusen player run enta box wey im shoot but di keeper touch am go corner.

1″ Netherlands don pass di ball.

Dis na ogbonge match between two of di big teams for di world. A win for either of dem go carry them qualify to di round 16.

Match don begin

Both teams don comot for park wia dem sing dia national anthem.

Afta dat injury scare, France coach Didier Deschamps don drop Mbappe to di bench as les Bleus take on di Netherlands.

Mbappe don train wit di squad afta im get protective mask, but im for settle for a place on di bench.

Marcus Thuram dey replace di Real Madrid star for di starting eleven.

Atletico Madrid star Antoine Griezmann dey lead di team as captain to face di Dutch for dia second game at di Euros.

Meanwhile goal hero Wout Weghourst gat to settle for place on di bench for Netherlands afta im last-minute goal win di game for dem vs Poland.

Confirmed line-ups

Netherlands XI: Verbruggen (GK); Van Dijk ©, Ake, De Vrij, Frimpong, Reijnders, Schouten, Simons, Dumfries, Gakpo, Depay

France XI: Maignana (GK); Upamecano, Kounde, Saliba, T. Hernandez, Tchouameni, Rabiot, Kante, Dembele, Thuram, Griezmann ©

BACKGROUND

France captain and Real Madrid star Kylian Mbappe na di biggest news for dis ogbonge match afta im break nose for dia last match with Austria.

Sabi pipo begin dey worry if di former PSG forward go fit to continue di tournament afta dat injury.

But im train wit protective face mask wia im dey in line to lead for di les bleus vs Netherlands game.

France manage to get a 1-0 win courtesy own goal by Austria while Netherlands grab a late winner afta substitute Wout Weghourst enta game for di final minutes.

Both teams don struggle for dia opening game but dem get three points – wit Poland and Austria both wit zero points for Group D.

Mbappe don score more goals against Netherlands (6) dan im score against any oda team, na so pundits and fans go dey expect say im go continue dat leg.

France win di Euros two times for 1984 and 2000 while Netherlands win am for 1988.

Dis ogbonge clash go happun for di Red Bull Arena Leipzig by 8:00pm WAT Friday 21 June, 2024.

Netherlands vs France head-to-head

Dis na di fourth time dis two teams go meet for di Euros.

France win with penalties for di 1996 quarter finals but Netherlands don win two group stage meetings – 3-2 for 2000 and 4-1 for 2008.

But for all competitions, France don win seven of dia last eight games vs di Dutch; di only one dem lose na di 2-0 loss for di UEFA Nations league for November 2018.

If you wan follow di history of dis two teams, sabi pipo dey expect say one team go win – sake of out of di 30 matches between di two, France win 15, Netherlands win 11.

In all dat time, di Dutch don score more goals for dis games – 57, while France score 53.

Build-up to di clash

Manchester City defender Nathan Ake know say dis clash fit to define dia tournament.

Im tok say dem wan adjust tactically from wetin dem do against Poland to get di result.

“Everibodi dey fit, we wan adjust few tins to get wetin we wan achieve – we dey look am di whole week”.

Ake tok say “di game wit France na big game, wey if you wan top di group, you need to win your two games – dat be wetin we wan do.”

“Our aim na to win.”

For France star Antoine Griezmann, di team get confidence say dem go get good result.

“We get some areas to improve but we dey ready for dis game. We need to link up better and for us take our chances,” di Atletico Madrid star tok ahead of di clash.

Despite di fact say France beat Netherlands two times for di qualifiers for dis tournament, Griezmann sabi say those games different from dis one.

“For di qualifiers, some of dia players don injure so dis na different game, we need to stand up and be counted.”

Di two coaches, Didier Deschamps and Ronald Koeman dey upbeat about dia chances.

Koeman tok say, “we sabi wetin to expect from dis French team wey dey play at di top level for many years, we need to play wit courage wia we need to take initiative”.

Deschamps also know say dis game go dey crucial if dem go qualify to di round of 16.

Im tok say, “our target na to qualify – we need to ensure say we perform very well and be dangerous for di opposition.”

“Netherlands get stronger team now from di qualifiers wen plenti of dia players don hurt.”.

Possible line-ups

Netherlands XI: Verbruggen; Dumfries, De Vrij, Van Dijk, Aké; Reijnders, Schouten, Veerman; Simons, Depay, Gakpo

France XI: Maignan; Koundé, Saliba, Upamecano, Hernández; Dembélé, Kanté, Tchouaméni, Rabiot; Griezmann, Mbappe

Source