Arsenal vs Man United highlights: Xhaka, Bukayo Saka and Tavares give Gunners victory over Man United for Emirates despite Ronaldo goal

Arsenal boost dia chance of qualification for next season Champions League as dem knack Manchester United 3-1 for Emirates stadium.

Early goal from left back Nuno Tavares and Bukayo Saka penalty bin see di Gunners dey cruise for first half before Ronaldo pull one back before half time.

Di Portuguese only return to di starting line up afta im bin miss United last match as im bin dey mourn im son.

Di game for get different outcome if to say Bruno Fernandes convert second half penalty wey for draw di game level but im kick hit di post.

Granit Xhaka come seal di win and di three points for Arsenal as im fire hot shot wey De Gea no fit stop from 25 yards in 70 minutes.

Victory for Arsenal over United see dem end a good week wia dem also defeat Chelsea 4-2 for Stamford Bridge on Wednesday.

E also see di Gunners climb into fourth, six points ahead of United wey dey sixth position. Arsenal go remain dia if Tottenham fail to win dia own match against Brentford.

For United, dis na dia second defeat in a week wia dem name Erik Ten Hag as dia new manager to replace interim coach, Ralph Rangnick.

How di match go

Second half

46 mins – Arsenal don restart di second half.

50 mins – United need to ginger demsef for dis second half if dem want any point from dis game. As e stand, Arsenal go go six points ahead of dem if di game end like dis.

51 mins – Tavares dribble Dalot but later blaze im shot way over.

55 mins – Penalty to Manchester United! Matic head corner wey hit Nuno Tavares hand.

57 mins – Bruno Fernandes penalty hit di post. Arsenal 2-1 Man United

Manchester United midfielder Bruno Fernandes

Getty Images

Di midfielder kick hit di post go out for goalkick.

60 mins – Ronaldo goal, no! VAR say im dey offside before im bicycle kick di ball into di net. United fans bin don begin celebrate.

62 mins – United don hit di post again, dis time na Ramsdale save Dalot shot hit di woodwork.

64 mins – Substitution for Arsenal, Martinelli don come on for Emile Smith Rowe.

67 mins – Yellow card for Granit Xhaka.

68 mins – Anoda Arsenal player don collect Yellow card. Dis tme na for goalscorer Tavares wey foul Elanga.

70 mins – Goal! Granit Xhala thunderbolt increase Arsenal lead.

Arsenal 3-1 Man United.

74 mins – Arsenal winger Bukayo Saka no go fit continue dis match, im don come off for Rob Holding wey replace am.

76 mins – Yellow card for Bruno Fernandes. Im step on Tavares, VAR bin check am but decide say no be red card tackle.

77 mins – Substitutions, Rashford and Lingard ON. Matic and Elanga OFF.

79 mins – Yellow card for Mohammed ElNeny.

82 mins – E be like na Yellow card period now as Victor Lindelof don see yellow for foul on Nketiah.

84 mins -Bruno Fernandes wey miss penalty to equalise for United don come off for Juan Mata.

90 mins – Substitution for Arsenal. Takehiro Tomiyasu don come on for Cedric Soares.

We don enta four minutes extra-time.

90+2 mins – Yellow card for Ronaldo afta im foul Tomiyasu.

First half

1 min – Under di sunny Emirates stadium, di away side don take di first kick of today match.

Di two sides bin observe minute of applause for former Arsenal player, Steve Rowley wey live from 1958-2022.

In di opening stages, United foul Bukayo Saka.

3 mins – Goal! Arsenal take early lead. Saka take down Xhaka cross nicely, David de Gea save im shot but Tavares tap in di rebound. Arsenal 1-0 Man United.

Tavares

Getty Images

6 mins – Elanga run through Arsenal defence afta Ronaldo find am wit through ball. Im later shoot but Ramsdale save am go out for Corner. From di Cornerkick, McTominay head wide.

8 mins – Arsenal fans begin clap afta di seventh minute to honour Cristiano Ronaldo wey lose im son during di week.

Meanwhile Saka dey down dey receive treatment.

10 mins – Arsenal nearly give United opportunity to equalise. Goalkeeper Ramsdale pass ball give Bruno Fernandes wey try to take quick shot, di Portuguese shot bin dey go post but Gabriel block am go out for corner.

15 mins – Anthony Elanga dey cause Arsenal problems down dia left side. Di teenager run pass Tavares come dey one-one wit Ramsdale but fall inside di box, referee Craig Pawson say no penalty.

19 mins – Martin Odegaard blaze one freekick over di bar.

21 mins – Ronaldo try im luck from outside di box, di shot go over di bar.

24 mins – United don begin press Arsenal and dem want penalty afta Sancho dey claim say di ball hit Cedric Soares for hand. Referee say no penalty.

Moments later United hit di cross bar wit outside shot from Diogo Dalot.

25 mins – Chance! David de Gea produce good save to deny Nketiah wey shoot straight at di United goalkeeper.

27 mins – Arsenal striker Eddie Nketiah score di Gunners second but VAR don rule say di Englishman bin dey offside.

But VAR dey check if Telles foul di Saka inside di box before Nketiah score di offside goal.

29 mins – Yellow card for Alex Telles

32 mins – Afta delays, referee Pawson signal for penalty.

Goal! Saka score from di penalty.

Ronaldo

Getty Images

34 mins – Goal for Man United. Arsenal 2-1 Man United. Ronaldo tap in cross from Nemanja Matic. Di Arsenal defenders no even see wen im run pass ddem meet di ball.

36 mins – United defender Alex Telles bin need treatment afta head collide wit Cedric.

39 mins – Elneny test De Gea wit outside shot. Di goalkeeper save di ball go out for corner.

45 mins – Referee don add five more minutes before half time.

45+2 mins – Alex Telles hammer shot goalwards, Ramsdale save am and straight from di corner Arsenal counter.

Odegaard finally receive di ball and shoot shot wey De Gea save well.

Half time – Arsenal 2-1 Man United

Arsenal vs Man United team news

Arsenal: Ramsdale, Soares, White, Gabriel, Nuno Tavares, Odegaard, Smith Rowe, Elneny, Saka, Nketiah.

Subs: Lacazette, Holding, Tomiyasu, Pepe, Sambi Lokonga, Martinelli, Azeez, Swanson, Leno.

Man Utd: De Gea, Dalot, Lindelof, Varane, Telles, Matic, McTominay, Fernandes, Elanga, Sancho, Ronaldo.

Subs: Bailly, Jones, Maguire, Mata, Rashford, Lingard, Wan-Bissaka, Garnacho, Henderson.