Namibia court rule say ban on gay sex no dey constitutional

Pipo hold rainbow Pride flag

Getty Images
“E no go be crime to love anymore,” di campaigner wey carry di case go court tok.”

For inside one ogbonge ruling for gay rights campaigners, court don rule say laws wey ban same-sex relationship between men no dey constitutional for Namibia.

Pipo wey court find guilty for di colonial-era offences of “sodomy” and “unnatural sexual offences” no common but e ginger discrimination against gay men wey dey live in fear of arrest.

For Namibia, no law dey wey forbid sex between women.

To marry pesin of di same sex still dey illegal for di southern African nation.

But if same-sex couple marry for abroad and one of dem no be Namibian citizen, dia union go dey legally recognised.

Afta dem read out Friday judgement for one high court for di capital, Windhoek, campaigners for di LGBTQ group Equal Namibia share foto of pipo wey dey hug outside di courtroom.

“Welcome to a new Namibia. A born-free Namibia,” di group tok on social media.

‘I no dey feel like criminal again’

Na one Namibian activist wey im name na Friedel Dausab bin carry di case go court, wit support from di British charity Human Dignity Trust.

“E no go be crime to love anymore,” Oga Dausab tok, as e dey react to di ruling. “I no dey feel like criminal wey dey on di run for my own kontri just because of who I be.”

E tell Reuters news agency say im “just happy”.

Di UN don also hail di ruling, dem call am “powerful step” towards a more inclusive nation wey go also improve access to health services and HIV treatment.

Meanwhile, di rights group Amnesty International don ask di Namibian government to ensure di safety and dignity of LGBTQ pipo.

Dem tok say dem don already document instances of “alarming” and “threatening” speech for di kontri during di run-up to di court case.

Na Germany first colonise Namibia, dem gain independence from South Africa for 1990 afta one long war.

Several kontris for Africa don cancel di anti-LGBTQ laws in recent years, but South Africa na di only kontri wia same-sex couples fit marry and adopt.

Source