Latest transfer news: Tottenham sign Joe Hart – See latest gist from Chelsea, Manchester United, Arsenal and oda clubs

Former Burnley and Manchester City goalkeeper Joe Hart don join Tottenham Hotspur on free transfer.

Hart, 33, sign two-year deal with Spurs after e comot di Clarets wen e contract expire on 30 June.

Tottenham announce Hart signing on Tuesday and he go compete with Paulo Gazzaniga to be Hugo Lloris’ deputy for di north London club.

Meawhile Former Manchester City playmaker David Silva don join La Liga side Real Sociedad for two seasons.

Di Spaniard 10-year spell for City end afta Saturday Champions League defeat by Lyon.

Oda transfer gossip

Liverpool, Manchester City, Chelsea, Manchester United, Tottenham and Leicester don ask Brighton about di potential price of 22-year-old English centre-back Ben White, wey impress on loan for Leeds last season. (Sun)

Arsenal dey draw up di formal paperwork for striker Pierre-Emerick Aubameyang new three-year deal wey worth more dan £250,000 per week. (Mail)

Manchester United dey eye Juventus 29-year-old Brazilian winger Douglas Costa as dem start dia summer transfer business. (Sky Sports)

Juventus dey interested in Arsenal French striker Alexandre Lacazette, 29 (Sky Sports)

Dem don tell Chelsea say dem need to pay £90m or face missing out on Bayer Leverkusen playmaker Kai Havertz, 21. (Star)

Barcelona dey set to begin attempt to re-sign Neymar from Paris St-Germain as dem dey look to recover from dia Champions League exit. (Mail)