Fotos: Protest of electricity tariff hike from across Nigeria

Labour Union members during di protest for electricity price increase for Abuja

BBC

Members of di organised labour don carry waka go offices of di Nigerian Electricity Regulatory Commission (NERC) and distribution companies (DisCos) nationwide sake of di increase for electricity tariff.

NLC, TUC wey bi join bodi of workers for Nigeria bin start di protest early mor-mor Monday to show dia stand for di new price of electricity for Nigeria.

Di workers block di entrance of distribution companines for different states across Nigeria as dem agree for dia circular wey bin direct dem to block di electricity providers dem.

Di union members for dia ‘I no go gree’ waka no allow staff of electricity company enta dia compound – dem ask authorities to reverse di tariff increase.

Oga pata-pata of di Labour union for Nigeria Joe Ajaero wey lead di protest for di federal capital territory, Abuja tok say workers on minimum wage of N30,000 per month no fit afford to feed much less increase tariff “for darkness”.

“Wetin di NERC and di Ministry of Power suppose focus on na how to increase power generation for di country, no bi how to dey increase tariff.”

Di power wey Nigeria dey generate now no dey enof to power only Lagos sef.

“Again, no Nigerian dey more important dan anoda so e no make sense say some pipo go dey get 20 hours of electricity and odas no go dey get. Even for South Africa during di time of apartheid, dat kain tin no happun.

Dat magic you wan use to give some pipo 20 hours, use am to give everybodi 20 hours also Ajaero tok.

NERC chairman, Sanusi Garba for im response bin tok say dem don note di concerns of Nigerians and go carry am to di policy makers.

Sanusi Garba bin also tok about estimated billing, e say di commission bin don issue some orders to di distribution companies to limit how much dem go fit bill customers.

“On prepaid meters, di President don approve di presidential metering initiative and e give deadlines to meter all customers for Nigeria.

“Any DISCO wey tell you to buy meter, report to di commission, and any DISCO wey bill you above di cap set by di commission, report dem also, Garba tok.

Di federal goment bin approve di increment for di electricity tariff for customers wey dey band ‘A’ for April.

Di upward review of di electricity tariff go start wit immediate effect, dem tok for di announcement.

NLC oga, Joe Ajaero address di public during di protest for electricity price increase for Abuja

BBC
NLC president Joe Ajaero
Labour Union members during di protest for electricity price increase for Abuja

BBC
Ibadan Electricity Distribution company

BBC
NLC members for Kwara state carry waka enta street to protest increase for price of electricity

BBC
NLC members for Ado-Ekiti carry waka go NERC office

BBC
NLC members for Ado-Ekiti carry waka go NERC office

BBC
NLC members for Osun state carry waka enta street to protest increase for price of electricity

BBC
NLC members for Osun state carry waka enta street to protest increase for price of electricity

BBC
NLC members for Ogun state carry waka enta street to protest increase for price of electricity

BBC
NLC members for Ogun state carry waka enta street to protest increase for price of electricity

BBC
NLC members for Ogun state carry waka enta street to protest increase for price of electricity

BBC

Procedure for electricity tariff review for Nigeria

According to one review guideline book wey NERC bin upload for dia website dem get Powers to make regulations for price of light aka electricity, e dey Section 76 and 96 of di Act.

E get three diferent types of review wey fit happun.

Minor review: Dis suppose happun twice inside one year

Major review: Dis suppose happun evri five years.

Extraordinary review: Dis fit shelle if special request dey say make di regulators change/update to some kind assumptions, dat na if evidence dey to back di effect on dia business.

Dis changes only suppose be sake of operating and capital expenditures, dat need dey for review to make sure say financial stability dey for di licensee.

And di Nigerian Electricity Regulatory Commission need consider di following tins for dia price review:

  • Inflation rate (di cost of living for Nigeria)
  • Global Gas price (wey don increase since 2015)
  • Nigeria exchange rate
  • US exchange rate
  • Average kilowatt wey Discos dey sell
  • Unit cost of power generation
  • Di total alias aggregate technical collection and commercial loses

According to NERC, di factors wey dey di list no dey in dia hands.

Source