Di biggest football stars wey dey on di move

footballers wey dey free for transfer market

Getty Images

Argentina legend Lionel Messi go join American side Inter Miami afta im exit from French champions Paris St-Germain.

Messi win Ligue 1 for di two seasons wey im spend for di club but dem comot for Champions League last 16, wey mean say im time for France no bin dey very successful.

Lionel Messi

Reuters

E score 32 goals in 75 games for di club – and end dis season wit 16 goals and 16 assists for Ligue 1.

Dis im Miami deal include collaboration from brands like Adidas and Apple.

But Messi no be di only big name footballer wey contract dey up.

Checkout oda ogbonge footballers inside dis tori.

Zlatan Ibrahimovic

Afta several years wit AC Milan, Zlatan Ibrahimovic dey retire from football.

During im career, im score 511 goals for nine different teams, including PSG, Barcelona and Manchester United.

Im retirement dey come afta im second spell wit AC Milan – e bin first join di club for 2010.

Ibrahimovic na Sweden all-time top-scorer wit 62 goals for im kontri.

Karim Benzema

Karim Benzema

Reuters
Ballon d’Or winner Karim Benzema na one of France greatest ever strikers

Afta 14 years wit Real Madrid, Karim Benzema dey leave di club for Al-Ittihad for Saudi Arabia.

Di French striker bin join Real Madrid for 2009, and during dat time e win di Ballon d’Or, award for di best footballer for di world.

Benzema also win five Champions League titles wit Real Madrid, as well as four La Liga titles.

Sergio Busquets

Di Barcelona captain go leave di club afta 18 years. Im play 718 matches for di club, di third-most appearances of any player for di club history.

During im time at Barcelona, di team bin win di Champions’ League three times.

Im also win eight La Liga titles, seven Spanish Super Cups, and seven Copa del Reys.

Im describe im time for Barcelona as “unforgettable journey”.

Although im neva tok im next move, tori be say di Spaniard fit move to one of di Saudi clubs dis summer.

N’Golo Kante

Ngolo Kante

Getty Images

Chelsea midfielder N’Golo Kante go be free agent at di end of dis month.

Di gist be say di French player dey close to agreeing terms to join Saudi Arabian club Al Ittihad.

Tori be say one delegation from di Middle East club bin dey London on Tuesday to go over di terms of di deal wey worth around £86million a year.

Kante bin dey tok wit Chelsea but negotiations neva see green light.

Sergio Ramos

Sergio Ramos

Getty Images

Defender Sergio Ramos dey leave French champions Paris St-Germain.

Ramos na di second high-profile exit wey di club announce afta Lionel Messi.

Di 37-year-old bin make 57 appearances for PSG and win two French titles afta im join dem from Real Madrid for 2021.

For now e no dey clear di club wey Ramos go play for next season weda im go remain for Europe or leave.

Roberto Firmino

Roberto Firmino

Getty Images
Roberto Firmino don spend eight seasons forLiverpool

Brazil forward Roberto Firmino dey leave Liverpool wen im contract expire at di end of di season.

Di 31-year-old don dey wit di Reds since im join dem for £29m deal from Hoffenheim for June 2015.

Firmino don help Liverpool win di Champions League, Premier League, FA Cup, EFL Cup and Club World Cup during im time for Anfield.

Im make 353 appearances for Liverpool, e score 107 goals and provide 70 assists.

Di Brazilian dey linked to Real Madrid and one club for Saudi Arabia.

Youri Tielemans

Youri Tielemans

Getty Images

Youri Tielemans contract wit Leicester City go run out dis summer.

D Belgium midfielder bin join di club on loan from Monaco for January 2019, bifor dem make di move permanent for den a club-record £40m deal for July of dat year.

Na di 26-year-old, wey score di winner for di 2021 FA Cup final against Chelsea.

E dey leave di King Power Stadium afta dia relegation to Championship.

Premier League club Aston Villa dey eye Tielemans.

Ilkay Gundogan

Ilkay Gundogan

Getty Images
Na him score City two goals for FA Cup final against Man Utd

Di midfielder, present deal for Manchester City go expire dis summer.

Na Gundogan, score di two goals as City beat Manchester United 2-1 for Wembley to win di FA Cup.

Next Saturday Champions League final against Inter Milan fit be di 32-year-old final City appearance.

E join City from Bundesliga side Borussia Dortmund for £25m for 2016.

Arsenal dey eye di German as well as clubs for Saudi.

Angel di Maria

Ange Di Maria

Getty Images

Di Argentine forward contract wit Juventus go expires at di end of di season.

Di Maria wey don play for clubs like PSG, Real Madrid and Manchester United na world cup winner.

Im fit decide to go back to Argentina to play bifor im retire.