Uefa Champions League prediction, kick-off for Wednesday games

PSG vs AC Milan

Getty Images
PSG dey second for group F, dem lose against Newcastle for Match day 2

Paris Saint Germain against AC Milan na di biggest game dis week for Champions League.

PSG go face seven time champions Milan, on Wednesday night for Parc des Princes stadium for Paris, France.

Di French side bin lose 4-1 to Newcastle for dia last match while di Italian side play goalless draw wit Borussia Dortmund.

Dat result mean say Newcastle dey top group F, followed by PSG and AC Milan dey third.

German side Borussia Dortmund dey last for di group.

Ahead of dis ogbonge fixture, Milan neva chop any goal for dia last four Champions League group stage matches.

So how dis game go end? football expert Sammy Wejinya analyse di PSG, Man City and Barcelona fixtures for BBC Pidgin and predict how e go end.

Na only di top two teams go qualify for di round of 16 while di team wey finish third go, drop to Europa League.

PSG vs AC Milan prediction

PSG vs AC Milan

Getty Images
PSG bin lose 4-1 to Newcastle

‘’PSG against Milan na ogbonge fixture, based on say di home team dey try to bounce back from dia defeat for match day two’’. Wejinya tok

If dem win and Newcastle fail to win against Borussia Dortmund den Luis Enrique team fit move on top di group.

But dis game go tough onto say di Italian side neva lose any game dis season for di competition.

Although dem bin lose 1-0 on Saturday to Juventus for Serie A.

No team don score against dem for di past four group matches for di competition.

I dey expect PSG to ginger well-well for dis game and Kylain Mbappe fit be di game changer for dem.

Prediction: PSG 2-0 AC Milan

Paris vs Milan Team news (21:00pm West African time)

Paris: Donnarumma; Hakimi, Marquinhos, Škriniar, Hernández; Zaïre-Emery, Ugarte, Vitinha; Dembélé, Gonçalo Ramos; Mbappé

Players wey dey out: Kimpembe, Mendes

Players wey go miss next match if dem collect card: Asensio

Milan: Maignan; Calabria, Thiaw, Tomori, Theo Hernández; Musah, Adli, Reijnders; Rafael Leão, Giroud, Pulišić

Players wey dey out: Caldara, Chukwueze, Sportiello, Okafor, Loftus-Cheek

Players wey fit no play: none

Players wey go miss next match if dem collect card: Musah

Barcelona vs Shaktar Donestk prediction

Barcelona vs Shaktar Donestk

Getty Images
Lewandowski bin score for Barcelona 5-0 win against Royal Antwerp

‘’Dis current Barcelona team better pass di one wey be fail to reach di knockout stage of di competition last season’’. Wejinya tok.

Di addition of Joao Felix don really change tins for di Catalans.

Joao Felix na dangerous player for Barca. Im score two goals against Belgian club, Royal Antwerp.

For Shaktar, dem recover from dia 3-1 home defeat to FC Porto for Match day one to win, 3-2 against Royal Antwerp for match day one.

Based on dia form dis season, I dey tip Barca to win.

Prediction: Barcelona 4-1 Shaktar Donestk

Barcelona vs Shakhtar Donetsk Team news (18:45pm West African time)

Barcelona: Ter Stegen: João Cancelo, Araújo, Christensen, Alonso; Fermin Lopez, Oriol Romeu, Gündoğan; Yamal, Ferran Torres, João Félix

Players wey dey out: De Jong, Gavi, Koundé, Lewandowski, Raphinha Sergi, Roberto

Players wey fit no play: Pedri

Shakhtar: Riznyk; Konoplia, Bondar, Matviyenko, Azarov; Bondarenko, Stepanenko, Sudakov; Zubkov, Sikan, Newerton

Players wey dey out: none

Players wey fit no play: Matviyenko

Players wey go miss next match if dem collect card: Konoplia, Sikan

Young Boys vs Man City

‘’Manchester City results dis season dey good but dia performance no too set like dat’’. Wejinya tok.

Wejinya say City playing style no dey like wen dem win di treble last season.

Surprisingly, dis season na Julian Alvarez dey shine and not Erling Haaland.

Alvarez get three goals in two games for Pep Guardiola team.

City opponents, Young Boys only get one point out of six for dia first two matches.

But dem don score for every group game so far .

Dem fit worry City small but I expect Pep Guardiola team to win based on di calibre of players dem get.

Prediction: Young Boys 1-3 Manchester City

Young Boys: Racioppi; Amenda, Benito, Camara; Blum, Lauper, Niasse, Garcia; Ugrinic; Itten, Elia

Players wey dey out: Imeri

Players wey fit no play: none

Man City: Ederson; Lewis, Akanji, Stones, Gvardiol; Kovačić; Bernardo Silva, Foden, Álvarez, Grealish; Haaland

Players wey dey out: De Bruyne

Players wey fit no play: none

Source