George Weah and Joseph Boakai go face each oda for run-off election

George Weah (L) and Joseph Boakai (R)

Reuters
Di two leading candidates, President George Weah (L) and Joseph Boakai (R), no meet outright majority

Run-off election go hold next month for Liberia afta one foto finish between President George Weah and im main rival Joseph Boakai.

Oga Weah get 43.83% of di vote and oga Boakai, one former vice-president, receive 43.44%.

Di 10 October election na di tightest presidential contest for Liberia since one civil war wen end about two decades ago.

Analysts bin don see say di election go enta run-off, but oga Boakai, wey be 78-year-old don try well-well by coming close to Mr Weah tally.

Di second round dey necessary as none of di candidate get more dan 50% of di vote for di first round.

Di run-off go take place on 14 November, di head of di electoral commission Davidetta Browne declare afta e announce di final results.

As per di new electoral calendar, di official campaign period for di run-off election go start from October 24th to November 12th.

Oga Boakai bin follow Weah for back bomber to bomber for di first round of voting for di 2017 election, and e lose for run-off wit a wide margin.

E fight dis election under di slogan “Rescue” as e accuse oga Weah – 57-year-old former international football star – say e take Liberia downhill during im first term.

Di president dismiss Mr Boakai allegations, e tok say im don make ogbonge achievements, wey include introduction of free tuition for university students.

For one press conference last week, oga Boakai bin urge im fellow opposition candidates to join di “rescue team for victory wey go loud”.

“We dey reach out to our brothers and sisters for di opposition and Liberians in general to join us for dis noble mission of making our country breathe freely again.”

Mr Boakai bin serve as vice-president for di goment of Ellen Johnson Sirleaf, wey become president afta di end of one brutal civil war about 20 years ago.

E promise say if dem elect am as president, im go form a “goment of inclusion wey go truly reflect di political, social and religious diversity of di citizens”.

None of di 18 oda candidates receive more dan 3% of di vote.

Source