Supreme Court building catch fire – Wetin happun?

Building of di Supreme Court for Nigeria catch fire on Monday morning.

Di building wey dey for di Three Arms Zone, for Nigeria capital Abuja contain di office of some justices.

E neva too clear wetin bin cause di fire but eyewitnesses say dem hear loud noise from di building bifor di fire start – fire fighters later quench di heavy fire bifor e spread.

Di Supreme Court Director of Press say na “normal electrical problem” cause di fire wey happun.

Dr Festus Akande, Director of Press and Information also confam say some documents burn.

E say di fire affect di chamber of one of di Supreme court Justices – but e no gree tok about di judge wey dey affected.

“Wetin happun na normal, may be electrical problem wey cause di fire outbreak,” im tok.

E say dia staff bin quench di fire wit di fire extinguishers wey dem get for dia office dem.

E say even though some documents bin burn, dem get softcopy of all di documents for dia e-library.

Oga Akande also deny tori wey dey spread up and down say di fire don burn di Presidential Election Petition Tribunal documents.

“Di fire no get anytin to di Presidential Election Petition Tribunal. Dem no dey discuss mata wey relate to PEPT for chamber plus dem no dey keep books, documents or anything wey gatz do wit di presidential election petition tribunal for chamber.” e tok.

Source