Ecowas chairman Tinubu send Abubakar, Sultan of Sokoto go Niger Republic

Protesters

ISSIFOU DJIBO/EPA-EFE/REX/Shutterstock

Chairman of Ecowas wey also double as Nigeria president, Bola Ahmed don send delegation go Niger republic.

Dis na part im many moves to try end di military takeover for West African kontri.

E give dem order to quickly settle all di current political palava for di kontri.

Di action dey in line wit di resolution dem reach last week for di Ecowas extraordinary summit wey hold for Abuja, Nigeria capital.

Na former Nigerian Head of State, General Abdulsalami Abubakar (Rtd) dey lead di delegation and e dey go Niamey on Thursday afta briefing by President Tinubu for di State House, Abuja.

Di Sultan of Sokoto, Alhaji Muhammad Sa’ad Abubakar III plus di President of Ecowas Commission, H.E. Omar Alieu Touray go join di delegation.

Di president don also send separate delegation wey Ambassador Babagana Kingibe dey lead to engage wit di leaders of Libya and Algeria ontop di Niger crisis.

Oga Tinubu wey follow di two delegations tok, say make dem discuss well-well wit all stakeholders wit a view to do wat ever e take to ensure amicable resolution for di situation for Niger for di purpose of African peace and development.

“We no wan hold brief for anybody. Our concern na democracy and di peace of di region,” di president tok.

General Abdulsalami Abubakar (Rtd) afta di meeting tok say di delegation go meet wit di coup leaders for Niger to present di demands of di ECOWAS leadership.

Di two leaders express positive outcome of di assignments.

Thousands dey march to support junta

Protesters

BBC

Thousands of pipo enta streets for Niger capital, Niamey, in support of last week military coup.

Dem condemn di actions of di West African kontris wey don impose sanctions on di kontri, dem also demand say make foreign sojas comot dia kontri.

US and France get military bases for di kontri wey dey help fight Islamist militants.

One similar protest wey happun on Sunday bin lead to attacks on di French embassy but Thursday demonstration dey peaceful.

France, wey be former colonial power for Niger don call on di military leader to ensure say di protest no happun again.

We neva receive any order to start military action for Niger – Nigeria Armed Forces deny report

Di Armed Forces of Nigeria (AFN) don come out to tok ontop one viral document wey dey spread for social media say dem wan begin dey deploy troops go Republic of Niger sake of di coup wey dey happun for di kontri.

Di armed forces tok say di report no dey true as dem neva get any order from any authority to begin military action against di junta for Niger.

Na on Wednesday report go round for social media say di armed forces don ready to go use military attack for di coup wey one junta begin for Niger.

Di document wey dey circulate for twitter handle say dem don begin dey mobilise military go Sokoto to launch attack for Niger Republic, but di defence headquarter say no be true.

Soldiers for di West African kontri of Niger on 26 July bin announce coup on national TV wia dem dissolve di constitution, suspend all institutions and close di nation borders. Di troops from di presidential guard hold Niger President Mohamed Bazoum before dem takeover.

General Abdourahmane Tchiani later declare imself di new leader of Niger afta di coup.

For di statement wey acting director of defence information Brigadier General Tukur Gusau release on Wednesday, im tok say meeting still dey on and no order don reach dem to ”commence military action against di military junta for Niger.”

Wen di coup matter for Niger begin dey enter serious level, leaders of di Economic Community of West African States (Ecowas) hold one emergency meeting for Nigeria capital, Abuja, wia dem discuss different resolutions.

Protesers for Niger

Getty Images
Map

BBC

One of Ecowas resolutions be say dem give Niger coup leaders seven days to restore power to elected president Bazoum. Di leaders of di West Africa regional bloc also add say make all land and air borders between Ecowas kontris and Niger close wit order of “no fly zone” on all commercial flights to and from di kontri.

Niger coup leader later condemn di sanction wey Ecowas impose. For di announcement wey dem make ontop television, General Abdourahamane Tchiani tok say di sanctions dey “illegal, unjust and inhumane” and im goment no go bow to the regional or international pressure wey go make dem reinstate President Bazoum.

Already, neighbouring kontris to Niger wey Burkina Faso and Mali, don also warn say any military intervention go turn to declaration of war.

Meanwhile, Ecowas reveal for dia meeting say military intervention go be di last option wey dem go take settle wetin dey happun for Niger, if oda option fail dem. Ecowas also call for meeting between all di West African defence chiefs as dem go meet from Wednesday reach Friday for Abuja, Nigeria’s capital, wia dem go deliberate ontop di situation for Niger.

Evacuees from Niger seen disembarking an Italian flight in Rome

Reuters
One Italian flight wey carry evacuees from Niger, including American nationals, land Rome on Wednesday

For di Ecowas Defence meeting, five kontris wey be Mali, Niger, Guinea Bissau, Burkina Faso, and Guinea no attend sake of say dem dey suspended from di bloc due to dia military takeovers. Na only Defence Chiefs from Ghana, Nigeria, Benin, Togo, Sierra Leone, Liberia, Senegal, The Gambia, Cote D’Ivoire, and Cape Verde dey present for di meeting.

As part of di resolutions wey Ecowas put in place to manage di crisis wey dey happun for Niger, dem send one delegation led by Nigeria’s former military head of state, General Abdulsalami Abubakar go Niamey, Niger’s capital make dem go follow di coup leaders tok wit peace.

Different kontri don also begin dey comot dia citizens for Niger sake of say di coup fit escalate pass wetin dey happun. Di US don announce partial evacuation comot for Niger embassy, UK don also comot dia pipo for di kontri and oda kontris dey follow for di evacuation process sake of safety of dia citizens.