Cynthia Morgan (Madrina) change Record label sake of Jude Okoye: See oda Naija musicians wey don get yawa wit dia managers

Many Nigerians waka enta social media on Sunday to tok about musician, Cynthia Morgan afta one Instagram live she do – reveal why her music career no too solid again.

Di 29 year old Nigerian singe explain say na afta she accept one contract from her former record label-North Side Music Ltd, Jude Okoye wey be music producer.

Ms Morgan say she no read di contract terms before she sign am and e affect her career well-well as she lost her stage name, Instagram account, royalty and VEVO account.

But Jude Okoye neva come out to reply all di claims wey she make for di Instagram live.

But wetin she tok don cause plenty gbasgbos for social media and oda pipo wey dia music career don enta gear one afta dem get yawa wit Jude Okoye or dia managers don also come out to tok dia own tori.

Odas e happun to

No be only Cynthia Morgan go get kwanta wit her manager, we sabi like four pipo wey get swey don bounce and odas still dey try find dia leg for di industry.

Madrina (Cynthia Morgan) change her name for September 2017 but di tori and for pipo because of di new song wey she release for May 2018.

  • Peter and Paul Okoye

  • May D
  • Kizz Daniel – Kizz Daniel bin get issues wit im manager Tumi Lwrence and im fire am
  • Brymo