Man United vs Southampton: Wetin di result mean for di Premier League table

Saints score

Getty Images

Manchester United play 2-2 draw with Southampton for dia premier league match on Monday for old Trafford.

Michael Obafemi na im equalise for Southampton from dia corner kick.Dis na afta Marcus Rashford and Anthony Martial bin give di Red devils di lead for first half.

Dis result mean say Man U still dey fifth position behind Leicester City and Chelsea wey dey third and fourth.

Man U next match na away to Crystal Palace on Thursday for Premier league.

Di match bin dey very important to Ole Gunnar Solskjær team and di race to qualify for next season Champions League afta Chelsea and Leicester drop points dis weekend.

How di table look now

EPL Table

BBC

Manchester United form

Ole Gunnar Solskjaer

Getty Images
Ole Gunnar Solskjaer Manchester United team dey unbeaten for 10 Premier League games

Manchester United bin dey undefeated for 10 Premier League games (W7, D3), di longest current unbeaten run for di division.

Dem bin dey undefeated for dia last 17 matches for all competitions (W13, D4), dia best run since dem go 18 games without defeat for March 2013.

Di Reds bin don lose just one of dia last 15 home league games (W9, D5), dem win di last four by an aggregate score of 13-2.

United victory against Aston Villa mean say dem be di first Premier League team to win four consecutive matches by at least three goals.

Dem need eight points out of di possible 12 in dia final four league fixtures to equal dia points total of last season (66).

United don win joint-record of 13 penalties for Premier League dis season.

Southampton form

Southampton don collect 27 points away from home dis season, wey rank dem fourth for Premier League.

Dem don score for 15 Premier League away matches dis season, a joint-league high alongside Chelsea, di only place dem no score na for Turf Moor and Anfield.

Danny Ings don score11 league goals away from home and 19 in total.