Artistes wey don fake dia deaths to blow

“If you fake your own death, you fit still no blow.”

Dis na sometin wey rapper, Falz bin put for im song ‘Softwork’ on top one controversial practice of di music industry wey be say dem go fake dia death to get more airtime for dia music.

Dis na apparently wetin happun for 15 November wen Nigerian rapper Oladips wey im mama call Oladipupo Olabode Oladimeji do wen im management bin announce im death.

Dis bin follow a month of tweets and social media post wey bin resemble man wey im mental health dey deal wit am.

Di day before im announcement, im bin post one video for im Insta Stories wey im reveal say dem don leave am alone for house and ask pesin make e do quick come.

One day afta im “death announcement”, Oladips drop im first eva album wey im call Superhero Adugbo.

But dat na also di day wey singer Qdot enta social media hala say Oladips still dey alive but no tok anytin to add to dat claim.

Dat na wetin make Nigerians start to speculate weda di Yoruba speaking rapper bin fake im death to generate free publicity for dis im first album.

Dis dey come as kontri pipo still dey try recover from di death of anoda music artiste, Mohbad wey Oladips even sing about for im single, Die Young.

One week afta di announcement, Oladips post video on im stories with proof of life, as di post wey announce im death don disappear from im page.

But no be im go be di only pesin wey don fake im own death, and many oda reasons dey wey pipo dey run dat kain parole.

Skibii

Nigerian musician Skibii, for 2015, bin trend wen tori comot outside say e don die.

Di mata happun a year afta e blow and recently e do interview wey im explain say wetin bin dey happun be say e get medical conditions.

According to di podcast wey happun for July, e explain say e get medical condition wey dey make am pass out steady.

E further explain say dat passing out for im broda yard, na im make pipo comot to say oh, e bin fake im death so im go blow.

Apart from Oladips and Skibii, e get oda pipo wey also don fake dia deaths sake of one reason or di oda. Dem include Susan Meachen and Thabo Bester.

Susan Meachen

Popular romance author, Susan Meachen bin fake her death by suicide from Facebook for September 2020.

Di Special Delivery author death bin dey faked on her Facebook page wey pesin wey claim to be her daughter claim say she take her life.

And na like that e go for two years until one day wey she burst pipo head and post say she don come back.

Tori be say she bin dey go through hard times, and according to wetin she tell one of her fellow writers, her family bin tink say na best way to give her space.

Thabo Bester

Thabo Bester

Getty Images

For 2022, South African Thabo Bester fake im death to run comot prison wey dem lock am inside for life say im rape and kill im babe.

Thabo Bester wey dem bin nickname, Facebook rapist for May 2022, bin fake im own death by pretending to light imself on fire for di prison cell wey dem put am.

E bin put anoda pesin bodi for di prison and escape for a year before dem capture am again for Tanzania.

Source