Who be di ministerial nominee wey faint?

Di ministerial nominee from Kaduna State, Balarabe Abbas Lawal collapse during im screening before di Nigerian senate.

Di incident wey throw di senate into panic happun on Wednesday inside di red chamber.

Di senate immediately suspend dia sitting and enta closed door session as di incident happun.

“Get di doctor and all camera’s should be switched off,” na so Senate president Godswill Akpabio tok as di incident dey happun.

For di video wey dey circulate pesin fit also hear anoda senator dey tok say make dem give di collapsed nominee “water and sugar”.

Oga Lawal na di former Secretary to Kaduna State goment.

We dey update dis tori

Source