How Paris dey prepare for di Olympics and Paralympics?

Olympic rings for Paris, wit Eiffel Tower for background

Getty Images

Dem light di Olympic torch for Greece on Tuesday, ahead of im journey to Paris for di start of di Games on 26 July.

Security don become major concern for di French goment, and plan for di opening ceremony dey unda consideration.

Wen dem wan hold Paris Olympic and Paralympic Games?

Di summer Olympics dey begin from 26 July to 11 August, wit 10,500 athletes wey go compete in 329 events.

Di Paralympics go start from 28 August to 8 September, featuring 4,400 athletes in 549 events.

Na 206 kontris dey represent for di Olympics, and 184 at di Paralympics.

More dan15 million tourists dey expected in Paris during di Games.

Where will Olympic and Paralympic events take place?

Di main athletics events go hold for di Stade de France, outside Paris.

However, na 15 Olympic and 11 Paralympic go dey di venue in central Paris. For example, di Pont d’Iena go host cycling event and di start and finish point for di marathon go hold at di Hotel de Ville and Les Invalides.

Map showing select Olympic and Paralympic venues for Paris

BBC

How France security forces dey prepare for di Olympics?

Worry dey about threat such as drone attack, di goment don cut spectator numbers for di Olympic opening ceremony.

Di event dey expect to see di national team wey go parade for boats along 6km (3.8 mile) stretch of di River Seine through central Paris.

Di original plan na for estimate of 600,000 members of di public to watch from di banks.

However, di goment tok say na only 300,000 invited guests dem go allow.

Artist's impression of the Olympic opening ceremony on the Seine

BBC
Di opening ceremony for di Olympics go feature parade of athletes on boats on di Seine

And President Emmanuel Macron don tok say di ceremony fit move from di Seine altogether if di security risk dey too much.

Instead, di entire event fit hold for di Trocadero or di Stade de France.

“We get Plan Bs and Plan Cs,” President Macron tok, adding: “We dey prepare dem in parallel, we go analyse dis in real time.”

French soldiers training for Olympic security duties in Gap, in southern France

BBC
French soldiers don do special security training ahead of di Olympics

Di French goment dey use about 20,000 sojas and more dan 40,000 police officers to provide security. Dem also receive support of about 2,000 troops and police officers from oda kontris.

Security services don dey screen one million pipo wey dey involve in di Games, including athletes, residents wey dey live close to di Olympic venues, medical staff and volunteers.

France Prime Minster Gabriel Attal tok say di intelligence services discover two plots against di kontri by suspected Islamic militants in early 2024. “Di terrorist threat dey real, e strong,” e tok.

Dem don ban Russia from Paris 2024?

Neither Russia nor Belarus dey allow to send dia teams, becos of Russia invasion for Ukraine and Belarus support for dem.

Competitors from dos kontris dey allowed to take part as neutral athletes.

Dem no go allow dem parade in opening ceremony and dem no go fit sing dia national anthems, or raise dia national flags, if dem win medals.

Opening ceremony of the 1984 Friendship Games in the Soviet Union

Getty Images
Di Soviet Union hold “Friendship Games” as rival to di1984 Olympics and Russia go do di same for 2024

Russia tok say dem dey “vex” for athletes treatment and e don announce “World Friendship Games” for Moscow and Yekaterinburg in September.

Di Soviet Union hold similar event in 1984, afta boycotting di summer Olympics wey happun for Los Angeles.

President Emmanuel Macron tok say Russia don dey conduct propaganda campaign to undermine di Paris Games.

Dis includ putting out stories wey claim say e dey badly organised.

Dem don ban Israel?

Russian foreign minister Sergei Lavrov criticise di International Olympic Committee (IOC) say dem no ban Israel from taking part, becos of im military operation for Gaza.

However, IOC president Thomas Bach reject di demand and confam Israel participation.

Di Games dey popular for France?

One opinion poll suggest say 44% of Parisians think hosting di Olympics na “bad tin”, as pipo dey plan to leave di town.

Bus and metro prices go double in Paris during di Games.

Actors model life-size versions of Les Phryges, the two mascots for the Paris Olympic and Paralympic Games

Getty Images
Les Phryges’ motto na “Alone we go faster, but togada we go further”

Di Olympic and Paralympic Village and na new aquatics centre wey dey north region of Paris wey dem sabi as Seine-Saint-Denis – one of di poorest parts of France.

Charities complain afta hundreds of squatters dey evicted from buildings close to di new venues.

Games venues in di centre of Paris go cordoned off to di public and there will be extensive traffic restrictions.

A number of Metro stations and railway stations go dey close for part or all of duration of di Games.

“Paris go dey unbearable,” one resident tell di BBC. “Impossible to park; impossible to move around; impossible to do anytin.”

Source