Manchester City vs Aston Villa highlights: Man City win EPL title, Liverpool finish second, while Arsenal dey go Europa league – See how e happun

Manchester City with Premier League trophy

Getty Images

Manchester City come from behind to beat Aston Villa 3-2 for Etihad and win di Premier League title

Arsenal hammer Everton but dem go go Europa League next season as a result of Spurs’ win for Norwich.

Tottenham Hotspur get spot for di Champions League as dem waya Norwich 5-0. Dem bin only need one point.

Manchester United calamity season end as dem finish sixth afta West Ham lose for Brighton.

Burnley dey relegated.

But na celebrations for Leeds for Brentford, but tears for Turf Moor.

Di Clarets’ six-season stay for di top-flight don over afta dia defeat to Newcastle.

Man City celebrate goal

Getty Images

See di Live Updates of Man City vs Aston Villa and Liverpool vs Wolves as e go

First Half!

Liverpool 0-0 Wolves

5 mins: Andy Robertson dey in space on di left for Liverpool but im cross dey too deep for ex-Wolves forward Diogo Jota.

GOAL – Liverpool 0-1 Wolves

Pedro Neto (2 mins)

Na long clearance from Jose Sa wey go over Ibrahima Konate head and straight to Raul Jimenez.

E pass am to Pedro Neto to tap home – for im first goal of di season.

Man City 0-0 Aston Villa

5 mins: Joao Cancelo poke am through to Gabriel Jesus but Robin Olsen gada am.

Liverpool 0-1 Wolves

10 Mins: Luis Diaz curl am in from di right and pick out Joel Matip. E nod am go wide.

Diogo Jota weave enta into di box but no fit find space to shoot.

Luis Diaz dey through for di box but im touch dey heavy. Jose Sa come out quickly to block am.

VAR check for a possible penalty but e no last long.

Man City 0-0 Aston Villa

10 Mins: Close one!

Fernandinho play one long ball over di top for Gabriel Jesus and e dey inches from getting a touch on am before Robin Olsen dive on top of am.

Dem come rush Olsen with backpass and smash am straight give Jesus. E bounce go back!

Liverpool 0-1 Wolves

15 mins: Liverpool dey come closer to a goal for Anfield. Di ball come in from di right, bounce off Willy Boly, e dey smashed towards goal by Naby Keita and e dey deflected behind for a corner. From di set-piece, Joel Matip header enta Jose Sa arms.

CLOSE CALL!

Liverpool dey play risky football.

Pedro Neto pick out Leander Dendoncker for di middle and e somehow fire am wide from a few yards out! Big chance.

Man City 0-0 Aston Villa

15 mins: Man City dey come closer too. Dem dey put Villa under pressure for di back and di visitors dey make mistakes.

John McGinn header result to corner.

E dey close!

Riyad Mahrez near di byline and pull am back towards Kevin de Bruyne.

Lucas Digne slide in desperately to block.

Man City 0-0 Aston Villa

20 mins: Kevin de Bruyne slide am in through to Gabriel Jesus but e no reach am.

SUBSTITUTION

Liverpool 0-1 Wolves

20 mins: Wolves goalscorer Pedro Neto don comot due to injury. Hwang Hee-Chan enta.

Sadio Mane celebrate

Getty Images

GOAL – Liverpool 1-1 Wolves

Sadio Mane (24 mins)

Di ball dey passed from di middle, Thiago pass am give Sadio Mane e no make mistake as e put am past Jose Sa.

Liverpool 1-1 Wolves

CLOSE!

25 mins:

Hwang Hee-Chan try to beat Joel Matip for di box but di Liverpool defender do well and win a goal kick.

Liverpool immediately go down di oda end as Luis Diaz try to curl am over to Sadio Mane but e dey cut out by Willy Boly.

Dem come again – Sadio Mane header dey cleared, Trent Alexander-Arnold shot dey blocked and Andy Robertson volley go over di bar.

Man City 0-0 Aston Villa

25 mins: Gabriel Jesus cross am in from di right. Tyrone Mings slide am in but Robin Olsen shout say e dey dia. Di ball nack am for face as e gada am and im injure im nose. Small blood flow.

Man City 0-0 Aston Villa

30 mins: Phil Foden slide in to win di ball and e set Gabriel Jesus clean through. E get Kevin de Bruyne in support but e choose to go alone and di shot no enta,

Dangerous cross from di right… Calum Chambers na im nod am.

Man City 0-0 Aston Villa

35 mins: Gabriel Jesus tease Tyrone Mings, e fake di cross, wait for Mings to go to ground, before e chip am back into di middle.

Im team-mates no fit reach am.

Matty Cash celebrate

Getty Images
Matty Cash celebrate

37 mins: Man City 0-1 Aston Villa

Goal!

Matty Cash

Aston Villa don take di lead for di Etihad!

Lucas Digne whip am in from di left, Matty Cash dey dia to nod am in and despite Ederson best efforts, e enta into di right corner.

39 mins: News don spread for Anfield of Aston Villa goal but dem need to be careful.

Hwang Hee-Chan dey played in behind and e dey one-on-one with Alisson for a tight angle. Di goalkeeper do well to get a touch on di shot to push am wide, though e fit bin dey head past di post anyway.

Man City 0-1 Aston Villa

40 mins: Another chance for Villa but Ollie Watkins get a lot to do. E enta di box but di angle dey tight and some few defenders dey back for City. E fire shot off but e dey blocked by John Stones.

CLOSE!

43 mins: Ollie Watkins dey through again! but e waste di opportunity to shoot. John Stones sprint back and block am

Liverpool 1-1 Wolves

44 mins: Liverpool still get di front foot for Anfield but Diogo Jota no fit get through on di right.

Jose Sa don go down off di ball e need treatment – na sometin of small concern.

46 mins: Man City 0-1 Aston Villa

Gabriel Jesus make one smart run in behind but Calum Chambers block di shot.

HALF TIME

Sadio Mane equaliser mean say Liverpool dey level on points with City but still dey lose out on goal difference.

Manchester City still dey lead di way… but only on goal difference.

First half end 1-0 against Man City

Getty Images
First half end 1-0 against Man City

SECOND HALF

SUBSTITUTION

Man City 0-1 Aston Villa

Pep Guardiola make im first move. Oleksandr Zinchenko dey on for Fernandinho.

SUBSTITUTIONS

Liverpool 1-1 Wolves

Enforced changes for Anfield. Liverpool James Milner dey on for di injured Thiago. John Ruddy dey on in goal for di injured Jose Sa for Wolves.

Man City 0-1 Aston Villa

50 mins: City don start di second half much beta dan di first. E dey pulled back from di left but Lucas Digne block am Gabriel Jesus nearly poke am in for di back post as di cross come in from di far side.

Sadio Mane goal dem disallow

Getty Images
Sadio Mane goal dem disallow

DISALLOWED GOAL

Liverpool 1-1 Wolves

51 mins: Sadio Mane score, Liverpool fans dey celebrate and dem tink dem dey top di table.

But na offside!

Everybody calm down.

Man City 0-1 Aston Villa

52 mins: At di same time as dem disallow Sadio Mane goal for Liverpool, Rodri smash one over di bar!

Liverpool 1-1 Wolves

53 mins: Trent Alexander-Arnold nip in to win di ball for Liverpool. E slip am through to Sadio Mane, E dey stopped by Conor Coady, en Diogo Jota rebound shot hit Mane. E dey ground.

SUBSTITUTION

Man City 0-1 Aston Villa

58 mins: Raheem Sterling dey on for Riyad Mahrez.

SUBSTITUTION

Liverpool 1-1 Wolves

58 mins: Mo Salah dey on. Diogo Jota comot. 58 minutes gone. Liverpool need to win.

Man City 0-1 Aston Villa

62 mins: Villa still dey hold strong. City dey win plenti corners and dem get space out wide but Villa dey reach di end of everytin in di six-yard area.

Liverpool 1-1 Wolves

65 mins: Trent Alexander-Arnold try from long range but e dey pushed away by John Ruddy. Mohamed Salah get di rebound but e put am over di bar and past di far post.

Philippe Coutinho score for Aston Villa

Getty Images
Philippe Coutinho score for Aston Villa

GOAL!

Man City 0-2 Aston Villa

69 mins: Philippe Coutinho score for Aston Villa.

CLOSE!

73 mins: Liverpool 1-1 Wolves

Trent Alexander-Arnold cut inside and hit am towards goal – e dey blocked by Willy Boly!

Quick VAR check for handball… Dem no give am.

SUBSTITUTION

Liverpool 1-1 Wolves

73 mins: Roberto Firmino dey on for Naby Keita.

GOAL ! Man City 1-2 Aston Villa

Raheem Sterling cross am on from di right and Ilkay Gundogan dey dia to head am over di line!

CLOSE!

Liverpool 1-1 Wolves

76 mins: Na two-on-one. Raul Jimenez dey away on di right but im pass to Hwang Hee-Chan no good.

Na simple ball. But e no do am well.

Gundogan first goal

Getty Images
Gundogan first goal

GOAL – Man City 2-2 Aston Villa

78 mins: Oleksandr Zinchenko pull am back to Rodri on di edge of di box and e drill am into di bottom left corner.

GOAL – Man City 3-2 Aston Villa

Ilkay Gundogan again.

Kevin de Bruyne whip am in from di right and Ilkay Gundogan, score again!!!

GOAL – Liverpool 2-1 Wolves

Mohamed Salah (84 mins)

Di ball dey cleared off di line initially from Joel Matip header but Mohamed Salah dey dia to put am over from di rebound.

SUBSTITUTION

88 mins: Man City 3-2 Aston Villa

Ashley Young dey on for Emi Buendia.

GOAL – Liverpool 3-1 Wolves

89 mins: Andy Robertson score di third goal for Liverpool.

FULL-TIME

95 MINS: Man City 3-2 Aston Villa

Manchester City na Premier League champions afta coming from 2-0 down to beat Aston Villa for di Etihad Stadium!

Liverpool 3-1 Wolves

All over for Anfield too. Liverpool miss out on di title by one point.