Details of why Jurgen Klopp go step down as Liverpool manager afta 23/24 season

Jurgen Klopp

Getty Images

Liverpool manager Jürgen Klopp don announce say im go step down as coach for di club at di end of di season.

Im tok di club ownership and di board about im decision.

Im two assistants Pepijn Lijnders and Peter Krawietz also go leave di club.

Klopp go continue to coach di team till di end of di 2023/24 season before im go end im 8-and-a-half year tenure.

“I fit understand say na shock to many pipo but I love everitin about dis club, di supporters and di staff,” di German tactician tok.

Klopp add say “dis na decision I for take at dis time of my career.”

Klopp don win six major trophies wit di club, wia dem currently dey lead di league table wit 48 points.

Liverpool appoint di german for October 2015 to change tins and bring back di club im past glory.

Im replace Brendan Rogers at di time.

For dat first season, Liverpool end di league for di 8th position.

Di club also lose 3-1 to Sevilla for di Europa league final.

But di club keep faith wit am say im go change tins for Anfield.

Klopp don guide Liverpool to back-to-back 4th place finishes afta dat season but im lose for di 2017/18 champions league final vs Real Madrid.

One of di highlights for im stint for di club he 2019 when im win di champions league afta beating Tottenham 2-0.

Dis na di club im sixth champions league trophy afta dia 2005 win vs AC Milan for di ‘miracle of Istanbul’.

Dat game, Liverpool come from 3-0 for first half to win on penalties.

Liverpool also win dia first premier league trophy since 1990 under di german tactician (2019/20 season).

Klopp also win FIFA Club World Cup, FA Cup, League Cup and UEFA Super Cup, as well as FA Community Shield for di 8-and-a-half year tenure.

Wetin di club tok

Oga for di Fenway Sports Group, Mike Gordon wey get primary responsibility for Liverpool tok say dem go adopt “business as usual” approach to di rest of di season.

Im meanwhile tok say dis decision go get big impact for di club.

“On behalf of John Henry and Tom Werner, we don appreciate Jurgen. Ibi sad tin say we dey lose pesin like dis wey be leader.”

Mike add say “we respect im wishes and di reason why im take dis decision.”

“As Klopp don wish, we go do ogbonge tribute for di appropriate time but we no fit hide di fact say im be one of di greatest blessings for our time,” Mike add.

Since di announcement, plenti pipo don dey tok say na bad timing, odas say im try im best for di club.

For di fans of di club, dis be bad news.

One of di club legends, Jamie Carragher don write for Twitter, “dis news na big blow to di club. I tink say im fit stay few more years.”

“What a manager. What a man. Make we go out wit a bang.”

Former English footballer and pundit Gary Lineker tok say “wow dis na big news. Klopp don do incredible job for Liverpool.”

Source