South Africa get legal standing to bring case against Israel – ICJ rule on war in Gaza

ICJ Judges

EPA

UN top court order Israel to take measures to prevent and punish direct incitement of genocide for dia war in Gaza, Reuters report.

“Di state of Israel gatz…. take all measures within dia power to stop di commission of all acts within di scope of Article II of di Genocide convention,” di court tok.

For one major ruling, a large majority of di 17-judge panel of di ICJ vote for urgent measures wey cover most of wetin South Africa ask for – and e dey notable say di court no order Israel to stop dia military action for Gaza.

ICJ president Judge Donoghue say South Africa get legal standing to bring case against Israel for wetin dem dey do far Gaza.

Israel no fit object to South Africa standing, Presiding Judge Joan Donoghue tok – adding say any party to di Genocide Convention fit bring case against anoda state.

South Africa get standing to submit di dispute wit Israel concerning alleged violations of obligations under di convention, she tok.

Di provisional measures wey di court issue

Some of di provisional measures wey di court make include:

  • Israel gatz take all measures to prevent any acts wey fit dey considered as genocidal – killing members of a group, causing bodily harm, inflicting conditions wey fit bring about di destruction of a group or preventing births
  • Israel gatz ensure say dia military no commit any genocidal acts
  • Israel gatz prevent and punish any public comments wey fit dey considered as incitement to commit genocide for Gaza
  • Israel gatz take measures to ensure humanitarian access
  • Israel gatz prevent any destruction of evidence wey fit help for di genocide case
  • Israel gatz submit a report to di court within one month of dis order wey dem give

We dey update dis tori

Source