Why Ecowas lift sanctions on Niger, Mali, Burkina Faso and Guinea

Ecowas

Getty Images

Di Economic Community of West African States (Ecowas) don lift sanctions dem impose on Niger, Mali, Burkina Faso and Guinea.

Di regional bloc take di decision for one extraordinary summit on di peace, political and security situation for di Ecowas sub-region for Abuja on Saturday 24 February.

Dem say dem fit now invite di four kontris to dia meetings related to security and peace.

Ecowas tok say di lifting of sanctions, wey go take effect immediately na on humanitarian grounds.

Di group also stress dia call for di release of Niger president, Mohamed Bazaoum, wey di kontri army still dey hold for detention.

Ecowas bin sama sanctions on di kontris afta dia military overthrow dia goments

Among di sanctions wey di group sama di kontri na di closing of borders and di cutting of electricity for Niger and oda economic sanctions.

For recent weeks, di kontris of Niger, Mali and Burkina Faso don declare say dem withdraw from di group afta dem accuse Ecowas say dem sama dem economic sanctions.

Ecowas bin don dey face pressure from organisations and individuals to lift sanctions against di kontris.

Even last week, di former military leader of Nigeria, General Yakubu Gowon wey be di only pesin wey remain among di leaders wey found di group, bin call on di leaders to lift di sanctions against di kontris.

Niger bin find diasef under di Ecowas sanctions afta di army overthrow civilian goment wey Mohamed Bazoum bin dey lead for July last year.

Ecowas meeting

BBC

Earlier dis month, Ecowas bin tok say dem no go recognise as Burkina Faso, Mali and Niger take comot for di organisation until di three kontris fulfil di requirements.

Dis na one of di decisions for di extraordinary meeting of Ecowas Mediation and Security Council wey happun for Abuja on Thursday.

Burkina Faso, Mali and Niger bin announce for January 28 say dem dey comot for Ecowas immediately. Dem later send formal notifications to the organisation di following day.

For di meeting wey dem do on Thursday 8 February, president of di Ecowas commission, Omar Alieu Touray, tok say di decision by Burkina Faso, Mali and Niger to comot for di organisation dey hasty and dem no meet di conditions for withdrawal.

According to di Ecowas treaty, e get one-year period bifor di notice of exit go take effect.

Touray also tok say di three kontris neva really reason di effect of dia decision on dia citizens.

However, di kontris wey dey comot still dey maintain say dia withdrawal from Ecowas na wit immediate effect. Dem tok say dem dey comot sake of di economic sanctions wey Ecowas bin impose on dem.

All three kontris dey currently under military rule sake of di coup d’etats.

Source