Risikat blue eyes: Eye color of Ilorin based Risikat Moromoke Azeez and her two kids dey totori many

Di eye color of Risikat Moromoke Azeez and her two kids in Ilorin north central Nigeria dey make pipo wonder.

Risikat blue eyes turn national mata afta tori land say her husband abandon her and her two pikins sake of dia eye colour, sumtin wey im don deny.

BBC Pidgin don gather some ‘charming’ fotos and videos of Risikat blue eyes just for you to see.

Risikat blue eyes

BBC
Risikat Moromoke Azeez and her two kids

Risikat Azeez and her two pikin fit get wetin dem dey call ‘Ocular Albinism’ wey be genetic condition wey dey reduce di colour for di back of di eyes.

Some tins wey pipo wey no know about di condition be say e fit affect as pesin dey see and di eye go dey sensitive to bright light.

As tins be so Risikat tori don go viral afta gist comot say her husband leave her sake of di blue eyes, but her husband Wasiu Dada don comot to say na dat blue eye attract and im not regret say dia pikin get di same blue eyes.

Ìdílé tí ọkọ da ọmọ síta tóríi ojú Búlùú tí wọ́n ní bá BBC sọ̀rọ̀
The British Broadcasting Corporation

Risikat blue eyes fit be some kind of congenital abnormality, according to Dr. Yetunde Oladipo.

If she no wear eye contact, she also no get any error of metabolism and she just get blues like that, e get as e be for medical field, di doctor tok.

“Most in born error of metabolism, di patients no dey stay long enough to even born pikin, but if she don grow old and alreadi get pikins then her case fit also be osteogenesis imperfecta.”

You know say medicine dey wholesome so before we go conclude we go need to know her medical history and we go need wetin she dey cope wit. Dr. Oladipo add.

“But if all of dis tins wey I don mention no follow, then e fit be say na so she (Risikat) dey [ie. na so her God make her come dis life] and no dey associated wit am. “

“Just being blue-eye for a Nigerian and nothing dey wrong wit di pesin, and di pesin no be Caucasian race, I go worry a little.” Di doctor tell BBC Pidgin.

To establish di authentic reason or cause of Risikat and and pikins eye colours, dem go need to run different tests for eye doctor alias Optamologist or optician.

See how Nigerians dey react to Risikat blue eyes for social media