Carabao Cup final: Chelsea vs Liverpool preview, team news and all you need sabi

Jurgen Klopp and Mauricio Pochettino

Getty Images
Liverpool Manager Jurgen Klopp and Chelsea Manager Mauricio Pochettino

Chelsea and Liverpool go face each oda for di final of di Carabao Cup on Sunday for Wembley stadium.

Dis match dey important well-well for di two clubs, but e dey more important for Chelsea.

Na di Blues first final since di reign of former owner Roman Abramovich end and also di first final since new owner Todd Boehly take ova.

For Liverpool, dis na one of di finals wey dem don play before and dem dey hope say e go go dia way.

While Liverpool main focus na di Champions League and Premier League title, dis Carabao Cup final na Chelsea main target for now.

Dis na sake of say dem fit use dis window enta di European Cup competition next season.

Chelsea neva go two seasons witout any trophy since 2000-2005.

And dis dey put Manager Mauricio Pochettino under pressure as im dey try win im first trophy for England.

Pochettino don enta two major finals before wit im former club Tottenham but e lose both.

Team news

Both Chelsea and Liverpool get injury problems and some of dia players go miss dis Carabao Cup final.

According to Chelsea official website, ogbonge defender Tiago Silva and midfielder Marc Cucurella fit miss di match as dem still dey try recover from injury.

Benoit Badiashile, Carney Chukwuemeka, Wesley Fofana, Reece James, Romeo Lavia and Lesley Ugochukwu dey out.

Di absence of Thiago Silver and Recce James fit worry Chelsea team.

For Liverpool, Alexander Arnold, Mo Salah, Jones, Diogo Jota , Nunez, Szoboszlai go miss di match sake of injury.

Jurgen Klopp go miss im midfielders Curtis Jones and Diogo Jota. E be like say goalkeeper Alisson too dey out.

“foreseeable” go be a worry – not just for dis game but for di remainder of di season.

But if Darwin Nunez and Mohamed Salah pass dia fitness before Sunday e go beta for Liverpool.

Wetin di managers tok ahead of di match

Chelsea Coach, Mauricio Pochettino tok say since Liverpool beat dem for Anfield, dem don click.

Im add say dem don also practice penalties well well and dem go fight for di trophy.

“I bin don win oda titles as coach but no be for England, I tink e mean a lot for us, di opportunity to reach di final and to challenge a team like Liverpool to win our first title for hia.

“No be di same same approach to play for di Premier League and for final and na for neutral place like Wembley, e dey different.

“Liverpool na competitive team. Dem sabi play well, so well, not so well, not so good. But dem dey very competitive and we need to match dem.

Meanwhile Liverpool Assistant Manager, Pepijn Lijnders say, “If we fit play like di second half against Luton, if dis young boys fit show passion, if dem fit show dia personality, den, for me, e go already be a good tin. And den di end result you no know, anytin fit happun.

We bin don play games wey we play well well but we lose, and we play finals wey e dey equal – see Chelsea against [Thomas] Tuchel wia dem cancel five goals, I tink for one game.

We dey always dey close wit dem dem – 11 penalties! But special games need special performances, so we get to focus on di performance. Special performances mean say we need to lift di stadium – we need di fans. We dey go for am.

Match stats

Chelsea and Liverpool bin don meet for two previous League Cup finals (2005 and 2022) and two previous FA Cup finals (2012 and 2022).

Dis na di first match wey dem go play in five different major domestic finals for English football history.

Liverpool

Liverpool dey make dia 14th appearances for di League Cup final and dia 44th appearance for Wembley. Na 22 times dem don win till date.

Liverpool dey hope to win di trophy for a record 10th time, if dem win dem go dey ahead of Manchester City.

Di Reds bin score di fastest eva goal and na against Chelsea. John Arne Riise strike afta just 45 seconds for 2005, but Chelsea win 3-2 afta extra-time.

Liverpool dey unbeaten for dia last eight meetings wit Chelsea for all competitions, since dia 1-0 league defeat for Anfield for March 2021.

Dem don also keep four clean sheets for dia last six meetings.

Liverpool don win all four of dia penalty shootout against Chelsea, dis matches na di 2007 Champions League semi-final, 2019 UEFA Super Cup, and di Carabao Cup and Emirates FA Cup finals of 2022.

Klopp lose just one of im 13 games against Mauricio Pochettino for im managerial career (win seven, draw five).

Chelsea

Chelsea bin don win di League Cup five times, di last time na 2015 against Tottenham Hotspur.

Chelsea na di only team wey stop Liverpool from scoring for dia last 12 Wembley visits – and dem do am two times.

Pochettino side bin reach di final afta dem beat AFC Wimbledon, Brighton & Hove Albion, Blackburn Rovers, Newcastle United and Middlesbrough.

In 34 games for all competitions under Pochettino so far, Chelsea don win 17 times, draw six and lose 11.

Head to Head

Chelsea and Liverpool bin don play 82 matches since 1995. Chelsea win 30 matches while Liverpool win 26. Dem draw 26.

Di two clubs bin don also jam for six major cup finals – dem be di 2005 League Cup final, wey Chelsea win 3–2 afta extra time.

Community Shield for 2006 wey Liverpool win 2–1. Di 2012 FA Cup final, wey Chelsea win 2–1.

Di 2019 UEFA Super Cup wey Liverpool win 5–4 on penalties, and di 2022 EFL Cup and FA Cup finals.

Source