Public holidays and days of observances in Nigeria for 2024

Man dey perform wit fire during di 62nd anniversary marking Nigerian Independence Day

Getty Images

As we enta 2024, say bye bye to 2023, dis na some of di days inside di new year wey Nigerians go get public holiday, plus days wey di goment fit no declare as public holidays but wey pipo go still observe becos dem dey special.

Christmas in London

Getty Images

Important days wey goment go declare as public holidays na:

January 1

Monday, January 1, wey be New Year Day public holiday. Di day mark di crossover from 2023 enta 2024.

March 29

Dis year 2024, Good Friday fall on March 29. Dis na Christian holiday wen dem dey remember di crucifixion of Jesus Christ and im death on Calvary.

April 1

Easter Monday for 2024 go be on April 1. Dis na na di second day of Easter and many kontris for world dey do public holiday on dat day.

April 10

Wednesday, April 10 fit be di day to celebrate Id el Fitr although goment go still declare am public holiday. Na di sighting of di moon go determine weda or not dat day go be Id day.

April 11

Thursday April 11 also fit be Id el Fitr. Dat day sha na public holiday.

May 1

On Wednesday, May 1, 2024, na International Workers Day and goment go declare public holiday.

Dis day wey dem dey also call Labour Day for some kontris, na day to celebrate labourers and working class pipo.

June 12

Democracy Day celebration na very important celebration for Nigeria.

On Wednesday, June 12, di goment go declare public holiday to allow pipo remember how di kontri return back to democracy for 1999.

June 17

Id el Kabir fit occur on 17 June, but dat go depend on weda or not dem see moon dat day.

Still Nigeria goment go declare dat day public holiday for Muslims to fit celebrate di Id.

June 18

Tuesday June 18 fit also be Id el Kabir additional public holiday.

September 16

On Monday September 16 goment go declare public holiday as Id el Maulud fit occur dat dey if Islamic council sight moon.

October 1

Nigeria Independence Day na on Tuesday, October 1.

Goment go give public holiday to remember di day wey Britain remove dia union jack flag put up di Nigeria flag as sign of di kontri independence.

December 25

December 25 na Christmas Day and dat dey na public holiday. Christmas na Christian festival to remember di birth of Jesus.

December 26

Boxing Day na holiday wey dem dey celebrate di day afta Christmas Day.

The Bauchi Durbar Festival

Getty Images
Durbar na ceremonial festival wey dem dey do during Id el Fitr

Important days wey dem no go declare public holiday but pipo go still observe and celebrate dem.

February 14

Wednesday, February 14 na Valentine’s Day. Even though goment no go give public holiday, pipo dey celebrate love specially on Valentine Day, so dem go observe dat day.

On di same February 14 go be Ash Wednesday. Dat day na special day of observation for Christians around di world. E go mark di beginning of fasting or lent for 2024.

March 8

On Friday, March 8, na International Women Day. Public holiday no go dey dat day, but for all over di world, pipo go celebrate di social, economic, cultural and political achievements wey women don make.

March 11

Islamic month of Ramadan fit start on di 11 of March. Dis day na very important day of observation for Muslims wey go begin dia one month fasting.

Di date no too sure becos e depend on wen di council of Islamic affairs sight di moon for di month of Ramadan. E fit be dat day or di day afta.

Children Day celebration for Lagos, Nigeria

Getty Images
Children Day celebration for Lagos, Nigeria

March 30

Holy Saturday na day of observation and e dey always follow di day afta Good Friday. Dis year Holy Saturday na on March 30.

March 31

Easter Sunday na on March 31. Dis day na very special day of observation for Christians as na di day wey dem dey celebrate di resurrection of Jesus Christ afta dem crucify am. Christians dey attend church pass on dat day.

May 27

On May 27 Nigeria go observe Children’s Day.

Even though public holiday no go dey, na very special day to celebrate di children. Different kontris get different dates wey dem dey celebrate di children of dia kontri.

24 December

Christmas Eve na on December 24. Dat day na day of observation for Christians as dem dey prepare to remember di birth of Jesus Christ on December 25.

December 31

December 31 na New Year Eve. Dis day na day of observation as pipo dey prepare to welcome di new year.

Source