Building collapse in Ikoyi: Femi Osibona whereabouts, updates afta 21 storey building crash

Di number of pipo wey don die from di Ikoyi building collapse don increase.

Lagos State goment announce say dem don recover about 14 deadi bodi so far – dis number dey likely to increase.

Authorities for Nigeria commercial capital say dem comot nine odas alive from di rubble and dis number too dey likely to increase.

Dis na di second day afta di high-rise building wey bin stand for Gerrard Road, Ikoyi fall down into pieces.

And dozens of pipo believed to be relatives and friends of those trapped inside di buried skyscraper tanda in front of di scene.

Dem dey look wit hopes say dia own pipo fit dey rescued alive.

Since di November 1, 2021 incident, different informate don comot including condolence message from di Nigerian President, Muhammadu Buhari.

One eyewitness say around 2:25pm on Monday dem notice say everywia bin dey shake and later di tall building fall down.

Here be ten of tins wey don happun since di Ikoyi high-rise building fall.

Rescue officials fit still hear signs of life for di rubbles

Even with di death toll increase, rescue workers for di building collapse on Tuesday say dem still dey hear signs of life from di rubble.

BBC tori pesin wey enta dem tell am say dem bin hear di voice of woman for di rubble and dem bin dey try to reach am.

Access to di 21 storey building crash site dey blocked

Di Lagos State goment don block di road wey dey lead to Gerrard road wia di building bin collapse.

Authorities don block di location make e help rescue efforts and access to di site.

21 storey building crash dey by major road

Di closure of di road leading to di building collapse site enable rescue operations go choke sake of say Gerrard Road na one major road inside Ikoyi.

Dis na as e follow connect one of di elite estates for Ikoyi Parkview and connect through Alexander to di Lekki-Ikoyi link bridge.

Civil engineers wey sabi dis kain constructions say e go require massive excavation, digging through di huge rubble and mangled irons, to fit save those wey dey trapped inside.

Building collapse in Ikoyi update: Tins wey happun afta 21 storey Lagos building collapse

BBC

President Buhari order full support for survivors

President Muhaamadu Buhari encourage authorities to step up efforts in rescue operations.

Di Nigerian leader also ask emergency institutions, including hospitals, to provide all di necessary support to safeguard lives of di pipo dem don rescue.

Buhari tok sorry give families wey don lost loved ones inside di Lagos building collapse while some still dey trapped.

Building collapse in Ikoyi death toll don increase

Lagos state goment tok for dia latest press release say dem don recover 10 dead bodies.

Howeva by 2pm on Tuesday 2 November, 2021 di report comot say 14 dead bodi na im comot from di building.

Three survivors don dey discharged from hospital

Lagos State Deputy govnor, Kadri Hamzat don announce say dem don discharge three pipo from inside di victims of di building collapse.

Ealso reveal say di six wey still dey hospital for now dey for stable condition.

Lagos State goment don announce say dem go handle hospital bill of survivors

On Tuesday, di Deputy Govnor of Lagos State, Kadri Obafemi Hamzat reveal say di state goment go pay medical bills for di rescued victims of di collapse.

E tok ds one even as im go di site to monitor di ongoing search and rescue wey dey happun.

Femi Osibona, di 21 storey building developer whereabouts

Olufemi Adegoke Osibona and Fourscore Homes Limited suffer huge loss on Monday wen 21 storey building for Gerard road Ikoyi collapse.

Osibona na di Managing Director of Fourscore Homes Limited and di developer of di 21 storey building wey collapse.

Unconfirmed reports be say oga Femi bin dey di site wen di building collapse.

But as at Tuesday evening, Femi whereabouts no dey clear while rescue effort dey in progress.

Lagos goment don suspend building control oga

Lagos govnor, Babajide Sanwo-Olu don order di indefinite suspension of di Lagos State Building Control Agency (LASBCA) oga, Gbolahan Oki.

Dis one na di first step in di investigation wey di state tok say dem go do on top di building collapse mata.

Rescue Operation still dey on

Na Army dey cordinate di rescue operations now for di collapsed building for Ikoyi.

According to di National Emergency Management Agency, dis no be mata, wey civilians fit handle now.

Building collapse for Ikoyi

BBC

Collapsed building in Ikoyi Lagos: Wetin we know about 21 storey building for Gerrard road

Di 21 storey building wey collapse dey located for 44BCD Gerrard Road, Ikoyi, one suburb area for di rich inside Lagos.

Na 4 Score Homes dey handle di construction of di project according to di informate wey dey di sign post in front of di collapsed building.

And di owner alias client of di building wey bin dey under construction na FHL – Fourscore Hieghts Limited.

Di structural engineers na Beyond designs while di architects na Voltron Design Studio. M&E na di consultants in charge of di construction.

Meanwhile, Prowess Engineering Limited wey bin dey in charge of di 21 storey building initially comot hand for di construction.

Dem comot bodi for February 2021 sake of say dem no share di same vision wit how di owner of di building dey carry out di project.

Prowess Engineering for inside letter wey dey dated to 20th February bin address am to one Mr Femi Osibona for Fourscore Heights Limited.

Dat time dem say dia intention to formally withdraw dia structural consultancy service from di “Proposed Gerrard Terraces for Fourscore Limited.”

Building collapse in Lagos: Ikoyi 21 storey building collapse for Gerald Road, many trap

BBC