Joy Nunieh biography, husband and wetin we sabi about di NDDC former MD wey dey kwanta Godswill Akpabio, Minister of Niger Delta

Joy Nunieh na di daughter of di first pesin to become lawyer for Ogoni land inside Niger Delta region of southern Nigeria.

Dr. Nunieh chop sack for February 2020 as NDDC Oga for insubordination afta she assume office as di Acting Managing Director of di Niger Delta Development Commission (NDDC) for October 2019.

Nunieh na River State indigene, one of di reasons why Govnor Nyesom Wike rescue her from arrest wen she bin dey travel go Abuja to for di NDDC probe.

Joi Yimebe Nunieh na im be her real full Ogoni name but many pipo dey call her Joy Nunieh.

Before she join di NDDC, she bin serve for as di National Coordinator of Hydrocarbon Pollution Remediation Project, (HYPREP). for 2012

HYPREP na institution wey dey under di Federal Ministry of Environment to do di following work for Ogoniland and other communities:

  • To determine di scope, means and ways to stop environmental damages wey dey happun for di communities
  • To do awareness on how to make sure say pipo around di community get better environment and livelihood.
  • Dem go also promote peace building efforts for di communities
  • Part of dia work na to strengthen governance, transparency and accountability for di region.

For her inauguration she tok: “We dey here because Mr. President expect us to do proper forensic audit of dis commission from 2001 to date. we no go compromise and di pipo go know say, new team don come to work.”

Joy Nunieh biography

Dr Joi Yimebe Nunieh na di fourth daughter of di first Senator and lawyer from Ogoniland, Late Sen. Cyrus Nunieh, from Beeri Khana local goment area.

Na 11 November na im dem born Nunieh and che be chief alias Gbene wey dem dey call di Esther of Ogoni land.Joi Nunieh wey study law for Rivers State University of Science and Technology RSUST bin don contest for di House of Representatives seat to represent Khana /Gokana federal constituency.

Joy Nunieh Husband: E no dey clear weda she dey marry as at today, but many pipo dey address her as Ms Nunieh – wey fit mean say she dey separated but BBC Pidgin understand say she get pikin.

From Joi Nunieh LinkedIn profile we gather say; Joy Nunieh be independent contractor for Shell petroleum company for 11 years from 2008-2019.

Nunieh na private contractor for 30 years for Chevron Oil Nigeria Limited from 1989-2019.

Madam Joy Nunieh serve as Acting managing Director of di NDDC within just four months before dem sack her for February. She accuse di Niger Delta affairs minister Godswill Akpabio say im get hand for her removal from office and na because she no gree sign oath of secrecy to all di mago-mago im dey do for di commission.

For one interview wit tori pipo, she also accuse di minister of bombing pipelines make dem for fit sack her from office.

But Oga Akpabio say dem sack Madam Joy sake of insubordination, Akpabio tok am wen he feature on AriseTV News Saturday night.

“My ministry wey dye supervise her write several letters to her but she no respond to anyone,” he tok.

Di minster say im don also receive petition from one petitions from one anti-corruption agency say Nunieh no get di rcorrect qualifications to work as di acting MD of a commission.

Joy Nunieh bin attend University of Portharcourt for her undergraduate studies.

Di Nigeria House of Representatives don summon di fmr Acting NDDC Oga to Abuja for investigative hearing on corruption matter and oda tins wey dey happun for di NDDC.

However, on Thursday morning some armed security men enta her house to arrest am before Rivers State governor, Nyesom Wike rescue her from di operation.