How farmer survive crocodile attack afta e bite di animal back

Foto of crocodile

PA Media

One Australian farmer wey bite crocodile wey attack am, say im dey lucky to dey alive.

Colin Deveraux na cattle producer wey bin spend one month for hospital afta one saltwater crocodile wey reach 3.2m (10ft) bite am for Northern Territory.

Im tell ABC News say im bite di crocodile eyelid as im dey struggle to survive.

Oga Deveraux say wahala start afta im stop for billabong (lake) as im dey travel to build fencing near di Finniss River last month.

Im bin stop for di lake side afta im notice fish dem wey bin dey swim for di middle of di waters. Afta im step away again, na im di crocodile “grab” im right leg, begin shake am like “rag doll” and pull am inside water.

Oga Deveraux tell ABC say first im bin try to kick di crocodile for im ribs wit im oda leg – before im bite di reptile back.

“My position be dey one kain… but na by accident my teeth catch im eye. Di eye bin dey very thick, like say you dey hold leather, but I go back to im eyelid and na so im take free me.

“I jump out and take off go wia my car dey. E pursue me small, maybe for four metres, before e stop.”

Oga Deveraux say im use one towel rope to stop di bleeding for im leg, before im brother drive am 130km (80 miles) north go di Royal Darwin Hospital.

“If [di crocodile] bin bite me for anoda place den di tori for dey different,” im tok.

“Dis mean say I need to change wetin I dey do. E don tey wey I don dey walk around dat swamp kontri dey fix fence and dey live life, but e don open my eyes.”

According to di local goment, crocodiles na di koko for di important industry wey dey for Northern Territory and dem dey protected by law.

Dem get ogbonge scientific and human interest and dem be valuable tourist attraction.

Di last deadly crocodile attack bin happen for April dis year for Kennedy River wey dey Cape York Peninsula, for Queensland.

Source