Champions League Matchday 4 prediction, kick-off time

Milan vs PSG

Getty Images

Bayern Munich, Barcelona, Manchester City and Real Madrid fit book dia place for di round of 16 for Champions League dis week if dem win.

Na dem bin di four teams out of di 32 wey don win all dia group stage matches dis season for di competition.

Many pipo dey tip dem as favourites to win di ogbonge tournament dis season.

Ahead of match day four, wey go shele on Tuesday and Wednesday, we go torchlight some of di big games for dis round.

Our football sabi pesin don drop im prediction for some selected games on Tuesday as di competition don cross half way.

Only di top two teams go qualify for di round of 16 while di team wey finish third go, drop to Europa League.

Tuesday and Wednesday go see a total of 16 games for Europe biggest club competition.

Milan vs PSG prediction

Milan vs PSG

Getty Images
Milan lose 3-0 to PSG for match day 3 for France

‘’PSG go fancy dia chances against dis AC Milan team based on di Italian team form.’’ Sammy Wejinya tok.

‘’Di Italian team neva win for dia last four games in all competitions, meanwhile, PSG dey on winning run of five games’’. E add.

I feel say Milan go step up on Tuesday night, dem need a good performance to stay alive for di competition but dis game fit hard dem.

Prediction: AC Milan 1-1 Paris Saint-Germain

Milan vs PSG Kick- off time (21:00 pm West African time)

Man City vs Young Boys prediction

Manchester City na one of di four teams wey dey fine form for di competition

Di defending champions don win all dia group games and dem fit book dia place for di round of 16.

‘’Man City morale high well-well for dis game against Yong Boys based on di 6-1 victory for Premier League dis weekend against Bournemouth’’. Wejinya tok.

Dis game no easy for Young Boys wey don score for all dia group match so far.

Prediction: Manchester City 3-1 Young Boys

Man City vs Young Boys Kick- off time (21:00 pm West African time)

Shaktar Donetsk vs Barcelona prediction

”Barcelona na favourites for dis match against di Ukrainian side based on dia head to head record.” Wejinya tok.

Shaktar Donetsk get two wins while di Spanish side get five victory.

Wit dia 100% record for di group stage, Xavi team go hope to kotinu dat form wen dem jam di visitors wey dem beat 2-1 last month.

Prediction: Shaktar Donetsk 1-2 Barcelona

Shaktar Donetsk vs Barcelona Kick- off time (17:45 pm West African time)

Borussia Dortmund vs Newcastle United prediction

‘’I dey expect Newcastle to ginger Borussia Dortmund for dis group of death game.’’

Based on di form of di two team, Dortmund lose 4-0 to Bayern Munich while Newcastle win Arsenal 1-0

St. James’ Park bin shock wen Newcastle United bin lose 1-0 to Dortmund for match day three.

‘’Dis match go tough for di two team, but Eddie Howe team go win’’ E add.

Prediction: Borussia Dortmund 1-2 Newcastle United.

Borussia Dortmund vs Newcastle United prediction Kick-off time (17:45 pm West African time)

Oda fixtures on Tuesday match day 4 fixtures 7 November

  • Atlético de Madrid vs Celtic (21:00)
  • Lazio vs Feyenoord (21:00)
  • Crvena zvezda vs Leipzig (21:00)
  • Porto vs Antwerp (21:00)

Source