Who be MrBeast, di American Youtuber wey build ‘100 wells’ for Africa

Leading US YouTuber and philanthropist MrBeast tok say im already know say dem go cancel am sake of di video e post wey show as e dey help pipo.

E tok dis one afta plenty reactions follow di post e share say im build 100 wells for Africa. Di post don receive plenty yabbings and hailings.

However, MrBeast don tok say im no care as im go always use im channel help pipo and im go try inspire im audience to do di same.

Na for weekend, 4 November, di Youtuber bin post on X (former Twitter) say “we don spend ova eight months working on tomorrow video and na di greatest tin wey I don ever do.” Na afta dat post, e share again say “We don build 100 wells for Africa” and e encourage pipo to go watch am on im YouTube page.

For inside di video wey don get ova 48 millions view since Mr Beast post am on Saturday, e show construction of 52 wells for rural communities for Kenya and 48 oda wells for Zimbabwe, Uganda, Somalia and Cameroon.

Plenty pipo don hail Mr Beast for helping rural communities as dem blame African goments, say dem dey embezzle di money dem suppose use fund for those kain projects.

But some Africans don condemn MrBeast say im video dey always show Africa as poor and backward continent.

Odas bin raise concern ova di environmental impact of the wells, dem tok say e fit contribute to reducing ground water.

MrBeast, wey im real name na Jimmy Donaldson, get 207 million subscribers on YouTube, wey make im platform di most followed account.

“I know say e dey one kain say na YouTuber dey do all dis stuff, but someone get to do am. And if no one else do am, we go do am. E really don change di communities wia we build dem,” Mr Beast tok of im motivation for di project.

Who be MrBeast?

Jimmy Donaldson aka MrBeast

Getty Images

Jimmy Donaldson, di pesin di online world sabi as MrBeast, na di biggest YouTuber on di planet – and dat im popularity follow plenty money come.

Di 25-year-old na di highest paid YouTuber for 2022 according to Forbes.

Dem born am for 7 May 1998 for Wichita, Kansas, America.

E start im Youtube channel for 2012 wen e be just 13-year-old. E bin start to dey post stuff like “worst intros” videos wia e go review small children wey get funny or bad intros.

Ova di years, as e begin get more money, e dey use dat money help pipo.

E bin branch out from video-making to do oda tins like get im own fast-food chain but na YouTube e for still dey popular.

For November 2022, Forbes estimate say e earn $54m (£42.5m) in a year from di platform, dem combine advertising revenue from videos and sponsorship deals. Since den, e don gain 60 million more subscribers on im main channel, wey don carry im total subscribers go 172 million.

Im biggest video till date, wey get 472 million views, na di Netflix hit Squid Game wey e recreate in real life, wey include a $456,000 prize fund.

Donaldson dey popular for im philanthropic work and many business ventures e establish.

E get licensed charity wey dey work as food bank wey e take dey feed communities across di US, and e don help raise raise tens of millions of dollars to help di environment.

How to make money from YouTube

YouTubers dey make an average of $0.018 per advert view, according to Influencer Market Hub. Rates fit range from $0.10 to $0.30 per ad view.

However, di amount of money YouTube dey pay depend on different factors, like:

  • Di number of views your video receive
  • Di number of clicks an ad receive
  • Ad quality
  • Ad blockers
  • Video length

Before pesin fit dey make money on YouTube, di content creator need to get at least 500 subscribers, three public uploads for di last 90 days, and either 3,000 watch hours for di past year, or 3 million YouTube shorts views for di past 90 days.

For long-form videos, YouTube dey pay creators 55% of di revenue from the adverts wey play for dia videos.

To get YouTube channel na correct side hustle, especially if you dey produce engaging content wey dey attract large audience. However, getting to di point wey you go dey make big money from YouTube na tough work.

One way to make na to allow advertisers run adverts on your channel through Google Adsense wey fit be way to monetize your YouTube content.

According to Google, di rates advertiser dey pay dey vary. Influencer Marketing Hub tok say dem dey pay between $0.10 and $0.30 per view. So for video wit 1,000 ad views, dem go pay di YouTuber $18, on average.

Source