Nigeria vs Australia highlights: How Oshoala, Ohale and Kanu goals give Super Falcons win against di Matildas

Oshoala

Getty Images

Nigeria Super Falcons beat di CommBank Matildas of Australia 3-2 for di Fifa Women World Cup group B game dem play on Thursday.

Australia na di 2023 co-host kontri with New Zealand.

Na di second game wey di Super Falcons of Nigeria go play for di tournament be dis and e happun for Lang Park, Brisbane, Australia.

Di Super Falcons bin get one point from dia first match against Canada wey end for a goalless draw and dem bin need dis win to strengthen dia chance of proceeding to di next round.

Di match as e happun live

Second Half

90+12 Mins: Game don end. Nigeria win. Dem come from behind to win

Australia 3-2 Nigeria

90+11 Mins: CLOSE!

Nnadozie with a fantastic save to deny di Matildas with an equaliser.

90 + 9: Mins: GOAL!

Australia 3-2 Nigeria

Di Matildas score.

90 + 4 Mins: Foord get one on one opportunity with di Super Falcons keeper but Nnadozie push di ball out.

90 Mins: 11 minute of added extra time.

89 Mins: SUBSTITUTION

40 years old Onome Ebi come in.

84 Mins: SUBSTITUTION for Australia

Raso dey out.

80 Mins: Anoda corner. At dis rate, I no fit count how many corners di Matildas don get.

79 Mins: Anoda fine shot from Foord and again e go just over di bar.

77 Mins: Anoda corner for Australia and e dey very very close. Kennedy head am and e go just over di bar. Very very close.

76 Mins: Corner for Australia, Cooney Cross take am but e lead to nothing.

Oshoala celebrate her goal

Getty Images

71 Mins: GOAL!

Australia 1 – 3

Oshoala score for di Super Falcons.

Dis na di kain experience Oshoala dey bring in.

Na tough angle for di Barcelona forward but she make am, despite di efforts of Arnold and Alanna Kennedy to clear am.

71 Mins: Corner taken by Australia but e amount to nothing.

70 Mins: Ayinde dey limp comot escorted by di medics after her encounter wit Raso.

69 Mins: Anoda free kick for Australia after a foul by Ayinde on Raso. Ayinde dey down though.

64 Mins: Corner for Nigeria!

Ucheibe take am for di Super Falcons and na goal!

GOAL!

Ohale score for di Super Falcons!

SUBSTITUTION

62 Mins: Ifeoma Onumonu and Uchenna Kanu come off for Asisat Oshoala and Esther Okoronkwo.

62 Mins: Di pressure dey build once again for di Nigerian goal.

60 Mins: Australia get a chance at di goal but no be di best of dia efforts and di Nigeria goalie easily stop am.

56 Mins: Gory and Payne both go for di ball and Payne go down and stay down. Medics dey check her. Di medics walk her out of di field.

51 Mins: Catley play am but e amount to nothing.

50 Mins: Foord get di ball and win corner for Australia.

46 Mins: Australian Gorry play shot but e go juts above di bar.

Australia 1-1 Nigeria

45 Mins: Game don start

First Half

45 Mins +5 Mins: Goal!

Nigeria score in di fifth minute of injury time!

What an end to di first half!

Na Kanu score di goal for di Super Falcons.

45 + 1 Mins: Goal!

Australia 1-0 Nigeria

Van Egmond score di first goal for Australia for injury time.

45 Mins: Five minutes of added extra time.

39 Mins: Free kick for Nigeria afta a foul. Payne take am. and a deflection from Plumptre but although e dey close, e no amount to anytin.

37 Mins: Cooney Cross play am but Nnadozie stop am.

36 Mins; Free kick for Nigeria. Dem waste di opportunity and counter by ustralia, Foord get di ball and Nigeria defence surround her and she manage to get a corner.

34 Mins: Anoda corner for Australia. Catley play am to Gorry, den anoda strike from outside di box no meet target.

30 Mins: Anoda corner for Australia, Catley play am, Raso try to get am on target but e go back of di net.

Australia dey press Nigeria bad bad.

28 Mins: Corner played but Nigeria defend am.

27: Mins: Ford again with di ball, she get support from Carpenter, to Cooney-Cross, den to Catley before e dey played to a corner

20: Mins: First booking of di game go to Nigeria Alozie for a foul against Australia player Vine.

18 Mins: Foord get di ball and manage to create space to play a shot but e go wide.

17 Mins: Kanu get di ball and run down to di penalty side but she lost her footing inside di 18 yard.

16 Mins: Nigeria take her first corner.

Nothing come out of am.

12 Mins: Corner kick played by Catley but e dey played out by Nigeria to anoda corner. Catley play am again and di Nigerian keeper Ajibade make a fantastic save to anoda corner. Catley play am again and Nigeria manage to play am out.

Nigeria defence don try for dis corners so far.

11 Mins: Australia Gorry play di ball into Nigeria Plumptre face and she dey down for some seconds.

9 Min: Super Falcons Kanu get di ball for good place close to di post but waste di opportunity as she no cross am well and nobody get di ball.

6 Mins: Anoda opportunity for Super Falcons but e amount to nothing.

3 Mins: Super Falcons get a chance for di penalty area but e dey stopped. Anoda chance wit a throw but Kennedy sweep am out. Australia don start beta dan Nigeria so far.

1Min: Corner for Australia, Catley play am but Nigeria stop am and play am out.

1 Min: Kick-Off. Game don start.

Australia and Nigeria key stats

Australia don win dia last three Fifa Women World Cup matches against African sides, including a 2-0 win against Nigeria for di 2015 edition.

Following dia 1-0 win against Republic of Ireland, Australia dey look to win both of dia opening two games at a single edition of di Women World Cup for di first time.

Following dia 0-0 draw against Canada, Nigeria go attempt to avoid losing consecutive games in a single edition of di Women World Cup for di first time wen dem play Australia.

Nigeria don fail to score in 17 of dia 27 games for di Fifa Women World Cup – more often dan any oda team.

Although Super Falcons of Nigeria na di most successful team for Africa. Dem be champions of di Africa Women Cup of Nations for 11 times. Na only two matches Nigeria don win for dia last 18 Fifa Womens World Cup.

Australia starting XI

  • 18 – Arnold
  • 5- Vine
  • 7- Catley
  • 9- Foord
  • 10. Van Egmond
  • 14- Kennedy
  • 15- Hunt
  • 16 – Raso
  • 19 – Gorry
  • 21- Carpenter
  • 23 – Cooney-Cross

Sam Kerr (calf), Mary Fowler (concussion) and Aivi Luik (concussion) no dey available for di match.

Nigeria starting XI

  • 16 – Nnadozie
  • 22 – Alozie
  • 2 – Plumptre
  • 3 – Ohale
  • 14 – Demehin
  • 7 – Payne
  • 18 – Ayinde
  • 10- Ucheibe
  • 15 – Ajibade
  • 12- Kanu
  • 6- Onumonu

Substitutes

  • 1 – Oluehi
  • 4- Ogbona
  • 5 – Ebi
  • 9- Oparanozie
  • 12 – Ordega
  • 11 – Monday
  • 8 – Oshoala
  • 19 – Echegini
  • 20 – Imuran
  • 21 – Okoronkwo
  • 23 – Balogun