Former Pope Benedict XVI don die – A look back on in papacy and life

Pope Emeritus Benedict dey attend Holy Mass for di beatification of Pope Paul VI

Getty Images

Former Pope Benedict XVI don die for im Vatican house at di age of 95, almost ten years afta im step down as pope sake of bad health.

Benedict bin lead di Catholic Church for almost eight years until 2013, wen im become di first Pope to resign since Gregory XII for 1415.

Benedict spent im final years for di Mater Ecclesiae monastery within di walls of di Vatican.

Im successor Pope Francis say im bin dey visit am dia frequently.

Vatican tok for statement: “Wit sorrow I inform you say di Pope Emeritus, Benedict XVI, pass away today at 9:34 for Mater Ecclesiae Monastery for di Vatican.

“More information go dey available as soon as possible.”

Although di former Bishop of Rome bin don dey sick for some time, di Holy See say im sickness bin get worse sake of old advancing age.

On Wednesday, Pope Francis appeal to im final audience of di year for Vatican to “pray special prayer for Pope Emeritus Benedict”, wey im bin say dey very ill.

Dem born am as Joseph Ratzinger for Germany, Benedict bin dey 78 win im become one of di oldest popes wey dem don ever elect for 2005.

For must part of im papacy, Catholic Church face allegations, legal claims and official reports of many years of child abuse by priests.

Earlier dis year, di former Pope bin accept say dem bin make mistakes on how dem take handle di abuse cases wen im bin be archbishop of Munich between 1977 and 1982.

Former pope Benedict, im papacy and resignation

Former pope Benedict, wey die on Saturday na di  first pope inside 600 years to resign from di post instead of to rule for life.

Dis na some tins you need to know about di 95 year old late former pope and im papacy.

First German pope in 1,000 years

Pope Benedict XVI

Getty Images

Benedict na di first German pope in 1,000 years.

Dem elect am on April 19, 2005 to succeed di very popular Pope John Paul II, wey bin rule for 27 years.

Cardinals chose am from among dia number as dem bin dey find continuity and wetin dem call “a safe pair of hands”.

For nearly 25 years, as Cardinal Joseph Ratzinger, im be di powerful head of Vatican doctrinal office, di Congregation for di Doctrine of di Faith (CDF).

Ogbonge theology traditionalist

Benedict bin be gbonge theological traditionalist, e no dey shake.

Ratzinger leave Germany and im post as archbishop of Munich for 1982 to head di CDF.

Di way wey im take discipline some Latin American priests wey bin dey promote Marxist-influenced Liberation Theology give am di nickname “God Rottweiler”.

Data pic of di late pope

BBC

‘Weak administrator’

Ratzinger na weak administrator wey agree say im “lack determination to lead and for taking decision.”

Im eight-year papacy bin get marks of missteps and scandal wey leak.

Im challenge Muslims by appearing to suggest say Islam dey naturally violent.

E make Jews angry by rehabilitating one Holocaust denier and cause international shock wen im say di use of condoms to fight against AIDS dey only worsen di problem.

Di 2012 “Vatileaks” scandal help loosen im papacy.

Paolo Gabriele, Benedict butler, bin leak secret documents wey show corruption and fighting within di Vatican.

Benedict say im stand down sake of bad health wey bin dey prevent am from bearing di full weight of di papacy.

Child abuse scandal

Child abuse scandals hunt most of im papacy but im get di credit for jump starting di process to discipline or expel dangerous priests afta a more relaxed attitude under John Paul II.

E order inquiry into abuse for Ireland, wey lead to di resignation of several bishops.

E discipline di late Father Marcial Maciel, founder of di Catholic order of di Legionaries of Christ and one of di Church most notorious hunters.

Di Vatican under Pope John Paul II bin fail to take action against Maciel despite all di plenty evidence of im crimes.

Im fail to take action for four cases

For 2022, one independent report for Benedict native Germany allege say im fail to take action for four cases wen im be Archbishop of Munich between 1977 and 1982.

Di old and weak former pope bin agree for one emotional personal letter say di errors bin occur and ask for forgiveness.

Im lawyers bin argue seriously say no be directly im fault.

Pope Francis greet Pope Emeritus Benedict XVI during one meeting wit newly named Cardinals for di Vatican Mater Ecclesiae Monastery

Getty Images

Fail to keep low profile

Although im bin promise to keep low profile afta im retirement, Benedict write, give interviews and, innocently or not, become lightning rod for traditionalists wey bin oppose Pope Francis.

Some loyalists fail to accept say im resign from di papacy willingly and continue to consider am as “my pope”.

Di “two popes” confusion kuku come get extra k-leg becos im choose to continue wearing white and want make dem know am as “pope emeritus”.

Dis resulting division lead to calls from both traditionalists and progressives for changes in Church law to regulate di functions and status of former popes.

Publish more dan 60 books

Benedict produce more dan 60 books between 1963, wen im be fada, and 2013, wen im resign.

“In reality I be more of professor, pesin wey dey reflect and meditate on spiritual questions,” Benedict tok afta im resign.

E bin frown at rock and roll

Im bin dey play piano and bin prefer Mozart and Bach.

As pesin wey love classical music, im bin frown at rock and roll as “expression of base passions” and one time im call popular music “cult of ordinariness”.