‘E be my school father’ – Fela grandson, Made Kuti marry im love

Made Kuti wey be di grand-son of di legendary afrobeat star late Fela Anikupalo Kuti don marry im love, Inedoye Onyenso wey dem meet for high school.

Made and im lover bin marry on Wednesday wia plenty celebrities bin dey present to celebrate wit di couple.

Made na di son of popular afrobeat legend Femi Kuti and Funke Kuti. Inedoye na fashion entrepreneur wey dey focus for different wears and accessories while Made Kuti take after im family music line.

‘We become Facebook friends’

According to di bride wey follow Bellanaija tok for one video interview, dia meeting first begin for high school wia Made Kuti be her school father. She tok say na funny tori but she come dey amazed say she dey spend her life wit am.

“We meet for high school. Na funny tori becos say na my school father. Im be veri good school father. We no even start to dey tok until many years later wey I don enta university,” di bride tok.

She reveal say dem no really start dia love tori for school like dat until Made comot come Nigeria. Inedoye explain say dem first become Facebook friends for 2018 wen Made come Nigeria and na from dia dem begin dia love tori

“How we graduate from school father and daughter relationship be say after im graduate, we become Facebook friends and na from dat time, im come back Nigeria for 2018 and den we begin from dat time,” she tok.

Who be Made Kuti?

Made Kuti na di son of Femi Kuti, di popular Nigerian afrobeat artiste. Im learn to play multiple instruments for di early age of 3 and na from age 8 im begin dey follow im papa band go tour.

Born in September 1995, Made music career bin start for im childhood. For 2020, im release im first single bifor e come join wit im papa to release a joint album.

Made also attend same Trinity Laban Conservatoire for London wey im father Fela Kuti attend, and im also attend Uxbridge College wia im study music.

Some celebrities wey show for di wedding

Even as di wedding no happun for weekend, e no mean say di owambe style no go dey.

Some celebrities go di wedding in colourful attire as dem celebrate wit di new couple.

As a close friend to Funke Kuti wey be Made mama, Kate Henshaw na one of di celebrities wey show face for di wedding. Truly she no be di mother of di groom but na she be di bestie of di groom mama.

Dressed in her combination of onion purple, grape and purple coloured headgear; Kate dey inside different videos dey jolly wit di mama of di groom for dance floor.

Shaffy Bello wey popular for her roles for different movies, also dey di dance floor wia she dey show her dance skills.

Timi Dakolo, di ‘Iyawo mi’ singer sing for one of di wedding celebrations. Im perform di ‘Iyawo mi song for di after party.

Source