‘I for die if say I no do music’ – Oda tins Tems tok

Tems attend 2023 Vanity Fair Oscar Party wey Radhika Jones bin host for Wallis Annenberg Center

Getty Images

Nigeria ogbonge international musician and Grammy award winner, Tems, say she for don die if to say she no do music.

Tems tok dis one plus plenty oda mata like di controversial dress wey she wear go di Academy Awards and her experience for Uganda prison, for one interview wey she bin do on Angie Martinez Show on Power 105.1 fm station, for New York City, US.

Di Grammy winner say, di way wey she take love music eh, say she for “die to make music.”

She say for her mind she bin no dey tink of making music to blow or “become famous,” she bin just wan sing, and she for do any tin to become musician.

“I for die to make music, not necessary to blow or dey famous. I for die to just make music for a living, becos back home music no just be profession wey pipo respect,” she tok. “No parent want dia pikin to do music.”

Tems share her experience, how she bin do office work, but afta some months she kuku give hersef advise say, dis no be wetin she wan take her life do.

Controversial Oscar dress

Dis dress make pipo para for social media say she block oda pipo wey go di Academy Awards

Getty Images
Dis dress make pipo para for social media say she block oda pipo wey go di Academy Awards

“I feel like say pipo dey so misunderstand me,” Tems say as she tok about di controversial big dress wey she wear go di 95th Annual Academy Awards on March 12, 2023.

During di award ceremony, pipo bin dey para for social media say her dress big so tey a block pipo wey sidon for her back, no allow dem see wetin bin dey happun for stage.

She say she bin no fit do anytin even though she know say di dress block pipo wey bin sidon for her back.

“Wetin I for fit do?” she ask. “I bin suppose change, but my phone no dey wit me, I bin no hold anytin, so di only tin wey I bin fit do na to just sit and pay attention becos all di tins wey bin dey happun online, I bin no know until I leave (di event).”

“I cry wen dem put me for prison uniform”

Di actress describe her two day prison experience for Uganda for 2020 wen she go do show as “set up.”

Even though di arrest happun during Covid year, pipo bin don begin go out and even di show organisers bin collect permit for di show.

She say she cry wen Uganda police carry her go prison, give her di prison uniform.

“As I dey waka enta (di prison), I begin cry becos dem give me my uniform. Di uniform smell no be small! Dem no wash am.”

Di wahala start wen one Uganda artist bin begin threaten her and her team wen dem reach di venue of di show, she say.

Afta I show, some police men wey no wear uniform come her hotel room come arrest her.

One tin wey di actress say she notice wen she dey for di prison for two day na say, di women wey bin dey di cell wit her no commit any crime.

One of di women tell her say she fight wit her hysband, n aim her husband call police for am.

Anoda woman tell her say na her broad call police for herskae of im no want make she follow am inherit dia papa land, na im im call police, dey pay dem money to keep her inside.

Tems say no single bed dey inside di cell wey dem keep her. Na only blanket and tissue di police give her as she enta cell.

Although her arrest provoke Nigerians, di musician say no diplomatic moves between Nigeria president and Uganda president na im dem take release her

“My manager papa gatz go Abuja go meet di president, every body bin dey call Uganda, di Uganda president.”

Tems na Nigerian singer, songwriter and producer.

She don release plenty singles and features wit Nigerian and international acts.

Temilade Openiyi alias Tems na 2 7 years-old – dem born for July 23, 1996.

She bin study Economics for one University in South Africa.

Dis na afta she attend Dowen College for Lagos.

Raised by her mama, Tems start her own music production at di age of 20.

Tems, wey be strong listener of Aṣa, Adele, Lojay, and Zinloeesky songs, no feel like a new comer for dis music game., according to one BET report.

Born in Nigeria, di Yoruba meaning behind Tems real name Temilade Openiyi na “my own na di crown”.

On August 31, 2021, di Nigerian singer become BET Amplified Artist of The Month of August 2021.

Source