Nigeria presidential election results 2023: Tribunal go begin hearing petition against Tinubu presidential election victory on 10 May

Di 2023 Presidential Election Petition Tribunal wey dey sit for di Court of Appeal, Abuja go begin hearing of di main issues on Wednesday, 10 May, 2023.

Dis na afta di panel of judges wey Justice Haruna Tasammani dey lead adjourn di hearing of di petition between Labour Party Presidential candidate Peter Obi and di President-elect, Bola Ahmed Tinubu of di ruling All Progressives Congress and di Independent National Electoral Commission (INEC) to 10 May, 2023.

Dem also adjourn di petition between Action Peoples Party, APP and Bola Ahmed Tinubu of di APC and di Independent National Electoral Commission, (INEC) on same date.

Earlier, Action Alliance (AA) withdraw dia petition against President- Elect, Bola Ahmed Tinubu of di APC and di Independent National Electoral Commission, (INEC)

Di panel of judges wey be Justice Stephen Ada, Justice Misitura Bolaji Yusuf, Justice Boloukouromo Moses Ugo, Justice Abba Mohammed accept di withdrawal of di petition.

Di panel say dem get di right to withdraw as e follow wetin dey inside di electoral act on dis ground dem dismiss di petition.

Afta di pre- hearing, di lawyers wey represent all di petitions and respondents tell tori pipo say dem go do dia best to make sure evritin go sharp sharp.

Meanwhile, Justice Haruna draw ear give all of dem say make dem no bring new grounds or technicalities again wen di main hearing start on Wednesday.

Di Tribunal adjourn till Tuesday to hear di petition between Allied Peoples Movement (APM) and INEC, APC, Bola Ahmed Tinubu , Kashim Shettima and Kabiru Masari.

Security tight well well for di Court of Appeal for Abuja and e dey expected to continue sake of di Presidential Election Petition Tribunal.

Di Independent National Electoral Commission (INEC) declare Tinubu as president-elect afta im score 8,794,726 votes.

Tinubu close rival Atiku Abubakar of di Peoples Democratic Party (PDP) poll 6,984,520 while di candidate of di Labour Party (LP) Peter Obi get 6,101,533 votes.

How we take get here?

Afta di presidential election wey shele on 25 February wey produce Tinubu as president-elect, Atiku, Obi, Solomon Okangbuan of di Action Alliance (AA) and Chichi Ojei of di Allied People’s Movement (APP) no gree for di outcome.

Di four candidates file case for di Presidential Election Petitions Court to challenge di results.

Atiku wey be PDP candidate want di tribunal to collect di certificate wey INEC issue Tinubu sake of say im no comply wit some of di provisions wey dey di electoral act.

Atiku also tok say Tinubu no qualify to contest sake of im alleged drug trafficking case for US.

Di PDP candidate want di tribunal to declare am as di winner sake of say na im come second.

Peter Obi on di oda hand dey call for cancellation of di presidential election and make INEC do fresh one.

Di LP candidate want di fresh election witout di APC candidate.

Obi also tok say Tinubu no win di required votes for Abuja.

Okangbuan also want make di tribunal cancel di election and add say INEC disobey court judgement to allow am take part for di election.

Di only female presidential candidate for di election, Ojei, also want INEC to collec di certificate of return from Tinubu.

She also tok say di APC candidate no qualify to contest di election.

Ojei tok say Tinubu no comply wit di provisions of di 1999 Constitution and 2022 Electoral Act.

Tinubu, Atiku, and Obi fit inspect election material

Afta di election, Tinubu, Atiku and Obi bin ask Court of Appeal for Abuja to grant dem request to cari out forensic examination of all di election materials wey dem use for di conduct of di poll, and make dem also give dem di Certified True Copy, of result of di physical inspection of di BVAS.

Dem also give INEC di go ahead to reconfigure di Bimodal Voter Accreditation System (BVAS) wey dem use for di presidential election.

Di court for dia unanimous decision by di three-member panel of Justices, rule say if dem stop INEC from reconfiguring di BVAS, e go affect di Govnorship and State Assembly elections of 11 March.Di court dismiss di objections wey Obi and im party raise against INEC move to reconfigure di BVAS.

How long e go take to get judgement?

Written result from di tribunal dey expected to happun in 180 days afta dem file di case.

Since di parties file differently di decisions go dey different.

But, di decision of di tribunal no dey final and di parties fit decide to go Supreme Court for a final verdict.

Dat process go take 60 days, so dem suppose make di final decision within eight months.