Max Air plane two tyre burst during landing for Abuja airport

Nnamdi Azikwe International Airport for Abuja, Nigeria capital don resume operations afta Max Air aircraft crash land for di airport on Sunday.

Di Minister of Aviation, Hadi Abubakar Sirika wey give di informate say, dem don comot di aircraft, sweep di runaway, carryout inspection and everything don dey okay now.

Dis dey come afta di airport officials temporarily close di airport sake of Max Air emergency landing on Sunday.

Max Air aircraft wey get 143 passengers and one small pikin on board experience some kain accident on Sunday wen im tyres burst during landing for di Nnamdi Azikiwe International Airport for Abuja.

Di Airline for one statement for dia Twitter handle confam di tori say two tyres of di plane bin burst as e land for di airport.

According to di statement, di plane bin comot from Yola, di Adamawa capital, northeast Nigeria, around 2:05pm and bin scheduled to land for di Federal Capital Territory by 3:00pm.

Dem say as di plane land, two tyres bin burst but di passengers and crew wey dey on board di aircraft dey safe and sound.

Di airline tok say dem don take all necessary steps to ensure say di passengers dey comfortable and say dem dey taken care of during dat time.

“We dey replace di aircraft tires and di aircraft go taxi go di ramp for further investigations before we release am for future flights,” di airline tok.

Dem extend dia appreciation to di airport authorities, emergency services and all relevant agencies wey respond promptly and professionally to ensure di safety of all passengers and crew on board.

‘FAAN staff dey responsive’

One eyewitness wey dey among di passengers of di plane Alhassan Umar Adamu say staff of di Federal Airports Authority of Nigeria (FAAN) dey “very responsive and responsible”.

For one video wey im post for im Facebook account, airport officials bin dey address passengers and also assure dem say dia luggages dey safe.

Adamu tok say di pilot sabi im job well-well and add say di fire service, ambulance, medical crew and security agencies bin dey on standby.

“Naso e suppose be for all airports across di kontri, no be selected ones. We give God di glory for saving our lives,” Adamu tok.

E add say flight in and out of di Nnamdi Azikiwe International Airport don dey suspended until dem clear di damaged plane from di tarmac.

Nigeria former Minister of Aviation and Director, Special Media Operations and New Media for di Tinubu/Shettima campaign, Femi Fani-Kayode, commend di pilot of di aircraft and di crew for dia tenacity of purpose and courage for flying and steering di plane to safety.

Fani-Kayode for im Twitter handle also tank God for sparing di lives of all di pipo wey dey di aircraft.

Di former Minister also tank di aviation parastatal agencies, di ground staff and di emergency services for Abuja airport for handling di situation wit di utmost professionalism and skill.

“May di Lord continue to watch ova our skies, grant our pipo and aircraft safe passage and protect our airspace,” Fani-Kayode add.