Niger coup update: Russia don give warning about Ecowas Standby Force wey dem wan send?

ECOWAS standby force

Getty Images

Russia don warn say military intervention for Niger go cause “long term kasala” afta di Ecowas say dem go assemble one standby force.

Di Russian foreign ministry say, dat kain intervention go destabilise di Sahel region as a whole.

Russia neva formally back di coup but di US say di Wagner group don dey take advantage of di instability.

On Friday,u8[;sdp-e coup supporters some wey bin dey carry di Russian flags go protest in front of di French military base near di Niamey capital, dey shout “down with France, down with Ecowas”.

France and di US get military bases for Niger and dem dey used to launch operations against jihadist groups for di wider region.

Military officials from Ecowas kontris suppose meet today to take arrange plans for di military intervention.

Dis na as West African leaders bin approve di use of armed intervention for Niger “as soon as possible” afta meeting to tok about di coup.

As at now too much information neva dey on top wetin dis standby force go be and who go dey inside.

Howeva from di extraordinary summit of Ecowas members on Thursday, Ivory Coast President Alassane Ouattara don reveal say im kontri dey ready to deploy around 850 and 1,100 troops go Niger as part of di regional intervention.

Also France and di US don reveal say dem support di Ecowas resolution on top dis Niger coup mata.

Meanwhile di Nigerian President of di Senate Godswill Akpabio bin tok afta di meeting say dia agreement na to advise president Tinubu to use tok-tok address di incident wey dey happun for Niger.

“Di Senate commend President Ahmed Bola Tinubu and oda Heads of States and goments Ecowas for dia prompt response and di position dem take on di unfortunate development for Niger Republic,” oga Akpabio tok.

Di lawmakers agree say make dia leaders meet wit di president as chairman of Ecowas to further “encourage oda leaders of Ecowas to strengthen di political and diplomatic options” and make dem find oda means to resolve di political wahala for Niger Republic.

Wetin be di Ecowas Standby Force (ESF)?

Di ESF na multidisciplinary force, dis mean say e dey come from different parts of di armed forces. Na multidisciplinary force wey dey made of di military, police and civilian staff from di Ecowas Member kontris dem.

Dia work na to provide pipo wey go participate for regional and continental peace support operations as well as intervention missions.

Dis dey come as Burkina Faso and Mali, both wey currently dey under miltary rule don hala say dem go take any military intervention as sign of war.

Di ESF na part of di Ecowas Conflict Prevention Framework (ECPF) of di regional bloc.

Im objective according to dis framework na to guarantee peace and security for mata of kasala and disaster wit di use of effective observation and monitoring, preventive deployment and humanitarian intervention.

Dia charter also include to train and equip multi-purpose complex units wey go get military and civilian parts from Member States and di way dem go run am na according to di arrangement of di African Standby Force.

Sabi pipo don tok say dis assembly of personnel fit take weeks to organise so e still leave room of pipo dem to tok with each oda.

Di work wey di ECOWAS conflict prevention framework dey do na to serve as standard wey Ecowas and di kontris under am go fit use to handle security mata for di region.

Dem dey use cooperative interventions to prevent violent kasala within and between member states. Dis framework dey also used to support peace building to places wey don recently face kasala.

Di full aim of di ECPF wey di ESF fall under na to strengthen di human security situation for West Africa. Dis mean dem go create conditions wey go comot any kain threat to di rights, livelihood, safet and life of pipo dem. E also mean di protection of democratic rights.

Dem det run dis purpose inside di Ecowas system by say dem arrange wia di kontris inside di joinbodi go fit collabo so dat if any threat weda e dey real or potential come, dem go fit run multi-actor and multi-dimensional action.

Na why di Ecowas Standby Force no dey get only military side but also civilian teams as well.