England vs Colombia: Kontris wey still dey & di ones wey don comot

Sweden's players celebrate scoring against Japan at the Women's World Cup

Getty Images
Sweden qualify for dia fifth semi-final for Fifa Women’s World Cup

Spain and Sweden don qualify for di semi-final of di Women’s World Cup for Australia and New Zealand.

Spain beat Netherlands 2-1 for di quarter final match to reach di last four of di competition for di first time.

Wit goals from Mariona Caldentey and Salma Paralluelo while Van der Gragt score for di Dutch.

And for di second quarter- final e also end 2-1, Sweden win Japan.

Na Amanda Ilestedt and Filippa Angeldahl score for di European kontri while Honoka Hayashi score for Japan.

Di Asian kontri miss penalty for di match.

All di African kontries don comot for di tournament, Nigeria, South Africa and Morocco go out for di round of 16.

While Zambia no pass di group stage

So which kontri still remain for di competition and which one don waka? We go torchlight dem inside dis tori.

Which kontri still remain for di Women’s World Cup?

France players celebrate their opening goal

Getty Images
France players celebrate afta dem score dia first goal against Morocco

Na six kontris out of di 32 kontries wey start di competition still remain for di tournament.

Di kontris wey remain na Spain, Sweden, Australia, France, England and Colombia.

But dat number go reduce to four afta Saturday match.

Tori be say afta Saturday quarte-final match di semi- final matches go happun on August 15-16.

Spain bin thrash Switzerland 5-1 while Netherlands beat South Africa 2-0 for di Round of 16.

Australia flog Denmark 2-0 while France knack Morocco 4-0 to reach di quarterfinal stage.

England win Nigeria 4-2 for penalty shootout afta dem bin play 0-0 draw, while Colombia win Jamaica 1-0 to reach di final eight for di first time for dia history.

Check out di full semi final fixtures hia:

August 15

Spain vs Sweden (09:00 GMT)- – Eden Park, Auckland, New Zealand

Check out di full quarter final fixtures hia:

August 11

Spain vs Netherlands, 1pm (01:00 GMT) – Wellington Regional Stadium, Wellington, New Zealand

Japan vs Sweden, 7:30pm (7:30 GMT) – Eden Park, Auckland, New Zealand

Kontris wey don comot for di Women’s World Cup?

Di Women’s World Cup for Australia and New Zealand produce some shocking results.

Some of di big kontris for women football fail to qualify for di group stage.

Kontris like Germany and Brazil no pass di group stage, dia performance for di tournament surprise many pipo.

Germany bin enta di competition as one of di favourites based on say dem bin reach di final of Euro 2022 last year.

Die Nationalelf manage to finish third for Group H, dem bin win Morocco 6-0 for dia opening game followed by 2-1 defeat to Colombia and den for dia final group game dem play 1-1 draw wit South Korea.

While Brazil 4-0 victory against Panama na di only match dem win for Group F, dem lose 2-1 to France and play goalless draw wit Jamaica to finish third.

Kontris wey comot for quarter finals for Women’s world cup

  • Netherlands
  • Japan

Kontris wey comot for di Round of 16 for Women’s world cup

  • Switzerland
  • Norway
  • South Africa
  • USA
  • Nigeria
  • Denmark
  • Jamaica

Kontris wey comot for Group stage for di women’s world cup

  • New Zealand
  • Philippines
  • Canada
  • Republic of Ireland
  • Zambia
  • Costa Rica
  • China
  • Haiti
  • Portugal
  • Vietnam
  • Brazil
  • Panama
  • Italy
  • Argentina
  • Germany
  • South Korea

Di final of di women’s world cup go take place on Sunday August 20 for Sydney Accor Stadium for Australia.