Liverpool vs Manchester City Premier League preview

Pep Guariola and Jurgen Klopp

Getty Images
Pep Guardiola and Jurgen Klopp bin dey tok during match for one Manchester City vs Liverpool match for November 2023

Liverpool go clash wit Manchester City as di race for di Premier League title kontinu on Sunday.

Liverpool dey second on di table wit 63 points while Manchester City dey third position wit 62 points. Arsenal dey lead wit 64 points.

We go know who di match go favour afta 90 minutes sake of say di two clubs strong well-well and dem no dey always gree for each oda.

Di eyes of club fans, including rival clubs dey for dis match, na around 3:45 pm Nigerian time e go start.

Anyhow e end banter go dey and dragging go dey for sure as e fit affect table toppers Arsenal.

Team news

Liverpool striker Mohamed Salah don come back from injury so im dey available. Salah comeback from im hamstring injury for midweek.

Dem go check Ibrahima Konate and Joe Gomez weda dem fit play. Di two players both comot from di match against Sparta Prague on Thursday sake of pain.

Manchester City go also check if Jeremy Doku and Matheus Nunes dey fit. Matheus Nunes finger bin dislocate during midweek.

Phil Foden suppose don recova from a dead leg wey im bin get against Manchester United, but Jack Grealish no go play at all.

Head-to-head

Liverpool bin don lose only one of dia last 20 meetings wit Manchester City at Anfield, dem win 13 draw 6.

However, di Reds only victory for dia past eight matches against City na 1-0 for dis same fixture last season.

Only two of di past 30 Premier League encounters na im di away team don win.

Liverpool

Di 20 times Liverpool bin win for di Premier League so far dis season don equal dia tally from di whole of last season.

Di Reds bin don win eight of dia last nine league games, except one 3-1 loss to Arsenal on 4 February.

Jurgen Klopp side get 22 points from losing positions so far dis season, e use one take pass Manchester City.

Ten Premier League goals wey Liverpool score for di 90th minute or later for di 2023-24 na dia joint-most goals in one season.

Substitutes bin don get hand for 22 Premier League goals for Liverpool dis season, dem score 11 and assist 11.

Darwin Nunez get eight goals and three assists for im past 10 appearances for all competitions.

Mohamed Salah get 11 goals and seven assists for im last 19 games against Manchester City.

Luis Diaz bin score for evri Liverpool last three home league matches and im dey unbeaten for all 29 of im Premier League appearances for Anfield.

Manchester City

Manchester City dey aim to win 10 away matches back to back for all competitions for di third time under Pep Guardiola.

Dem neva beat dem for dia last 12 league games, dem win 10 and draw two.

City dey hope to keep consecutive league clean sheets away from home for di first time since dia run of five for 2022.

Phil Foden wey bin get hand for 18 goals for di league so far dis season na di best return in a single campaign.

Foden tally of 18 goals for all competitions na also a career best in one season.

Erling Haaland don play three Premier League away games witout a goal.

Rodri dey unbeaten for im last 60 appearances for Manchester City, a run wey dey stretch ova one year since dia 1-0 defeat by Tottenham for February 2023.

Source