Real Madrid vs Barcelona: Aubameyang score twice for El Clasico to give Barcelon 4-0 win over Real Madrid

Real Madrid 0-0 Barcelona

Getty Images

La Liga league leaders Real Madrid suffer heavy 4-0 defeat from di hands of rivals Barcelona for El Clasico.

Pierre-Emerick Aubameyang score twice while goals from Ronald Araujo and Ferran Torres condemn Madrid to dia heaviest home defeat of dis La Liga season.

Di result no get much impact on di race to win La Liga but e show how far Barcelona don come since dem appoint dia former player Xavi earlier dis season.

Real Madrid bin don beat Barcelona twice dis season for league and for di Supercopa de Espana but dem look shadow of demsef without dia talisman Karim Benzema as Barcelona run riot for dia backyard.

First Aubameyang open di scoring wen im head home Dembele cross on 29 minutes. Di Catalans quickly double dia lead as Araujo jump high to head in anoda Dembele cross from cornerkick for 2-0.

Then Torres finish off good move early in di second half before Aubameyang score im second of di night for im first El Clasico appearance on 53 minutes.

Real Madrid go still remain top of La Liga wit 66 points, nine ahead of Sevilla wey dey second but dem no go happy to lose like dis to dia greatest rivals.

For Barcelona, dia run of form continue as dem don climb back to third position, equal on 54 points wit Atletico although Barca still get game in hand.

How di match go

Second half

Aubameyang

Getty Images

46 mins – Substitutions Camavinga don replace Toni Kroos while Diaz come on for Carvajal.

Straight from di restart Barcelona bin get opportunity to increase dia lead but Ferran Torres shoot wide.

48 mins – Goal for Barcelona! E no take long Barcelona don increase dia lead. Aubameyang back heel pass to Torres wey shoot first time past Courtois.

51 mins – Looks like Barcelona don score again. Aubameyang don grab im second of di night afta long delay to confirm from VAR.

53 mins – Goal given! Di referee don award di goal to Barcelona.

Dis no be joke. Real Madrid 0-4 Barcelona

56 mins – Real players dey look like say dem see ghosts as dem dey sbocked by di scoreline. Meanwhile Barca players look like say dem want more goals.

59 mins – Aubameyang almost score hat-trick but im stretched leg wey connect wit Torres cross no direct di ball to dey on target. Di Ganon striker dey enjoy life for Barcelona.

63 mins – Yellow card for Luka Modric. Real Madrid bring on Asension and Vazquez for Rodrygo and Nacho.

66 mins – Casemiro try im luck from outside di box. Im shot no trouble Ter Stegen wey watch as di ball go wide.

71 mins – Substitutions No hat-trick for Aubameyang today as coach Xavi don sub am.

Auba and De Jong don come off, Depay and Gavi na im replace dem.

74 mins – Jordi Alba collect Yellow card as im bring down Vinicius wey bin no dey happy wit di foul.

77 mins – Real Madrid get less dan fifteen minutes to find consolation goal for dis match.

Asensio just shoot wide. Dat na Real first shot for dis second half.

78 mins – Madrid goalkeeper Thibaut Courtois don dey very busy for dis match, dis time im save Depay shot.

79 mins – From dat Barcelona attack, Madrid create dia own chance. Alaba test Ter Stegen wit hot shot wey di German save.

80 mins – Substitution Xavi don send on Adama Traore for Ousmane Dembele.

82 mins – Camavinga don enta di referee notebook as im receive Yellow card for foul on Busquets.

86 mins – Substitutions Pedri and Alba OFF, Dani Alves and Nico ON for Barcelona.

88 mins – Lucas Vazquez recieve Yellow card for back-to-back foul on Barca players. Nico also collect Yellow for wetin im tell ref.

Full time Real Madrid 0-4 Barcelona

First half

1 min – Barcelona take di first kick as di match don start. Immediately Militao foul Ferran Torres.

Nothing come out of di freekick to trouble Real Madrid.

5 mins – Federico Valverde break free inside Barca half come pass di ball give Rodrygo. Di Brazilian shot hit di side netting.

Di fans be like say den ready well well for di match as dem dey cheer and shout about every good play so far.

7 mins – Save! Vinicius Junior dribble Araujo in and out come pass di ball give Valverde wey try to place im shot.

Ter Stegen save im shot go out for corner. Barca clear di ball afta.

10 mins – Aubameyang steal di ball from Nacho, im pass give Dembele wey try to dribble im way through Reak defence but Militao clear di ball.

12 mins – Double save! How Aubameyang no score dia? First Courtois deny di former Arsenal strike from five yards and den di Belgian also push clear Dembele curler.

14 mins – Di game don start so fast. Soon afta dat Barca chance, Vinicius test Ter Stegen wit low drive wey di goalkeeper catch.

17 mins – Ball Possession: Real Madrid 55% – 45% Barcelona.

18 mins – Ferran Torresss…wide! Di former Manchester City player try to bend im shot past Courtois but im bend am too much as di shot go off target.

22 mins – Yellow card for Toni Kroos wey foul Pedri.

24 mins – Pedri loop di ball over di Real defence to find Torres wey try to shoot but Militao recover quickly to block im shot. Di pass from Pedri na helele.

26 mins – Yellow card for Frenkie de Jong. Di Dutchman late tackle catch Kroos afta im don pass di ball.

29 mins – Goal for Barcelona! Pierre Emerick Aubameyang don head Barca into di lead from Dembele cross.

Real Madrid 0-2 Barcelona

Getty Images

Fantastic cross from Dembele. Dat na Aubameyang eight goal for im last eight games for Barcelona.

34 mins – Aubameyang almost extend Barca lead as im shoot from di left side but Courtois save am. Di Gabon forward dey worry Real Madrid.

36 mins – Real Madrid respond wit Vinicius clean through on goal, di forward trip imsef according to di ref wen im dey one on one wit Ter Stegen. Fans want Penalty but referee wave play on.

38 mins – Barcelona score again! Araujo jump high to head di Catalans 2-0 up for Bernabeau.

42 mins – Di match now na all Barca as Real Madrid no fit cope.

Half time – Referee blow whistle for half time as Barca dey fully in control of dis match.

Real Madrid 0-2 Barcelona

Team lineup

Real Madrid starting XI: Courtois, Carvajal, Militao, Alaba, Nacho, Casemiro, Kroos, Modric, Valverde, Vinicius, Rodrygo.

Barcelona starting XI (TBC): Ter Stegen, Araujo, Pique, Eric Garcia, Alba, Busquets, De Jong, Pedri, Traore, Ferran, Aubameyang.