Ministerial list: Senate screen Wike, El-Rufai, Edu, odas from Tinubu first ministerial nominees list

Di senate chamber of di national assembly don finally screen all di 28 ministerial nominees for di first list wey President Bola Tinubu send go di house.

Di senate president, Godswill Akpabio, begin di screening of di ministerial nominees on Monday 31 July.

Earlier on, President Tinubu bin send 28 names of ministerial nominees through im chief of staff Femi Gbajabiamila go di senate house make dem comfam dem.

On Monday, di senate president, wey preside over di plenary announce say na 16 names dem go screen for dis first stage and e no get any particular order but na 14 dem later screen.

For di last day of di screening, di remaining five ministerial nominees appear before di house. Afta di senators screen nine nominees wey appear for Tuesday, 1 August.

Abubakar Momoh from Edo State na di first nominee wey show for di house as dem begin di screening.

Former Govnor of Rivers state, Wike na di second nominee wey show up for di house and im present wetin dey im CV. Di senators no ask am too much questions sake of say senate president Akpabio tok say Wike na popular politician wey don appear before di senate before.

As di screening dey go on, di senate president clear say dem go still confam di nominees later afta dem conclude di screening. Akpabio add say to appear before di senate for di screening no mean say dem don confam di nominees as di senators go still carry out dia own security checks.

Meanwhile, small argument dey wen Professor Joseph Utsev from benue state appear for im own screening. One senator, Tokunbo Abiru representing Ikorodu constituency bin observe say di age wey dey di CV no tally wit wetin dey im academic qualification.

Afta dem drag di mata, di house later settle say make Prof Utsev go update im CV before di next appearance.

Uju Kennedy from Anambra state na di first female wey show up for di screening. Kennedy come from Akwa, Anambra state, South-East, Nigeria. She dey among di presidential aspirants wey step down for President Bola Tinubu during di All Progressive Congress (APC), presidential campaign for June 2022.

Pipo wey dem screen for Tuesday na David Umah from Ebonyi State, Olawale Edun from Ogun State, Nasir El-Rufai from Kaduna State, Ahmed Dangiwa from Katsina, Uche Nnaji from Enugu State, Stella Oketete from Delta State, Ekperikpe Ekpo from Akwa Ibom State, Hannatu Musawa from Katsina, and Adebayo Adelabu from Oyo State.

On Wednesday during di continuation of di screening, dem screen Dele Alake from Ekiti, Lateef Fagbemi from Kwara, Muhammed Idris from Niger, Ali Pate from Bauchi and Doris Uzoka from Imo.

Former Govnor Nasir El-rufai of Kaduna state and ogbonge financial expert Wale Edun dey among di ministerial nominees wey show up for di screening exercise wey happun for di second day at di upper chamber of di national assembly of Nigeria.

Wale Edun from Ogun state ansa different questions wey some senators ask am about how im take rescue Lagos state wen im be commissioner.

Wen former Govnor El-rufai appear for di screening, dem also ask am different questions before dem ask to bow comot di house.

For Wednesday, Doris Nkiruka Uzoka from Imo state be di last nominee wey appear for di senate screening.

Wen Doris appear bifor di senators, she tok about her achievement. She tok say she graduate as a medical doctor bifor she join di banking industry.

One senator, Titus Zam representing Benue north-west, ask di nominee why she abandon medical field for finance afta she don study medicine for school.

Doris tok say she desire to work for finance field as she don get several achievement but dat no mean say she abandon medical field.

During di plenary for Wednesday, Akpabio tok say make di nominees no tink say na di ministerial position wey dem tok about during di screening dem go get, but dem go look into dia portfolio and assign whatever suit dia capability give each pesin.

Afta di screening of 28 ministers for Wednesday, di senate president, Godswill Akpabio, announce di awaited second batch of ministerial nominees, he call out 19 names from di list.

Akpabio announce say di plenary go continue for Friday, 4 August but e no tok wen dem go begin di screening of di second batch of ministerial nominees, wey im announce for Wednesday evening.