New ministerial list 2023: Oyetola, Lalong, Matawalle, odas make Tinubu second nominees list

Nigeria senate don reveal di names of more ministerial nominees for President Bola Tinubu cabinet afta im chief of staff, Femi Gbajabiamila, present di second list of di nominees give di senate.

Dis time, na 19 names dey di new list.

Top among di nominees na di former Govnor of Osun state, Gboyega Oyetola, former Plateau state Govnor, Simon Lalong, former Zmafara state Govnor, Bello Matawalle and odas.

Di lawmakers bin suspend di rules of di chamber at 3:15 pm on Wednesday to allow di chief of staff enta di hallow red chamber to present di list.

E submit di list to di Senate President, Godswill Akpabio.

President Bola Tinubu on Thursday, 27 July bin send twenty-eight ministerial nominees give di senate for screening.

Di senate begin di ministerial screening on Monday 31 July and dem don screen about 18 of dem so far

Part of those wey dem don screen na di immediate former Govnor of Rivers state, Nyesom Wike and im colleagues from Kaduna state Nasir El-Rufai and former Ebonyi state Govnor, David Umahi.

Betta Edu, Uju Kennedy-Ohaneye, Abubakar Badaru, Abubakar Kyari, Dele Alake, and among odas too don take a bow afta senate screen dem.

Ministerial nominees for new list

Ahmed Tijani

Bosun Tijani

Dr Maryam Shetti

Ishak Salako

Tunji Alausa

Tanko Sununu

Adegboyega Oyetola

Atiku Bagudu

Bello Matawalle

Ibrahim Gaidam

Simon Bako Lalong

Lola Ade-John

Shuaibu Abubakar

Tahir Mamman

Aliyu Sabi

Alkali Ahmed

Heineken Lokpobiri

Uba Maigari

Zephaniah Jissalo