Sadio Mane: Liverpool forward dey on isolation after positive coronavirus test

Sadio Mane scores in Liverpool's 3-1 league win over Arsenal at Anfield

Reuters
Mane score inside Liverpool 3-1 Premier League win over Arsenal on Monday

Liverpool forward Sadio Mane don test positive for coronavirus and e do self-isolation.

Di tori dey come three days after di club say dia midfielder Thiago Alcantara don test positive for Covid-19.

Liverpool say di Senegal winger dey “show small symptoms of di virus but im dey feel good health overall”.

Mane, play for di Reds inside di 3-1 win over Arsenal on Monday but im no dey di team for di EFL Cup defeat on penalties wey Gunners waya dem on Thursday.

One statement ontop Liverpool website say: “Like wit Thiago Alcantara, Liverpool go continue to follow all protocols wey relate to Covid-19 and Mane go self-isolate for di required period of time.”

Mane, wey don score three goals for di Anfield club dis season, go now miss di Premier League game against Aston Villa on Sunday prior to di international break.