Fani-Kayode ask Daily Trust to pay six billion naira and apologise say dem ‘defame’ am

Nigeria Former Minister of Aviation, Femi Fani -Kayode dey drag local tori pipo for Daily Trust go court say dem spoil im name for one of dia publication.

Di gbas-gbos between di fmr. minister and di newspaper start afta oga Femi Fani-Kayode ‘insult’ dia reporter for press conference wey im hold for Calabar, Cross River Sate.

As e dey tok to local tori pipo to brief dem how e feel on top di work wey di Cross River state govnor dey do, na so one jornalist wey dey work for Daily Trust Newspaper ask am “who dey bankroll di tour?”.

Na so Femi Fani Kayode begin para and vex pour insult on di journalist.

‘Which kain stupid kwesion be dis?’, who dey bankroll who? (Femi Fani-Kayode hala for Eyo Charles di Daily Trust reporter).

Daily Trust later post one publication wit caption wey say, “FFK, The Drug Addled Thug In Designer Wears” to profile di former minister.

But for lawsuit wey Oga Femi lawyer publish, e tok say di headline na hateful and malicious publication wey try to bad mouth im client, sake of dis pipo don dey tok about about am and dem dey call on di local media to take down di article within 14 days or dia clientFemi fani-Kayode go seek redress for court.

Dem also ask di Newspaper to negotiate wit dia clients to pay di sum of Six billion and also apologise for two oda national newspapers sake of dis.

Di former minister bin tok sorry afta im insult di daily Trust reporter for one tweet wey im post.

https://www.facebook.com/watch/?v=802716727143475&extid=6XwR02XDDE6Zq6ax