Nigerian international flights resumption dey suspended till September

Nigeria don suspend international flight resumption date from 29 August, 2020.

Director General of Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA) Captain Musa Nuhu make di announcement for daily briefing of di Presidential Taskforce on Covid 19 inside Abuja on Thursday.

Meanwhile, Federal Airports Authority of Nigeria (FAAN) don increase passenger service charge by 100 percent.

From September 1, passengers wey dey take plane travel within Naija alias domestic flight go pay 2000 naira. Before na 1000 naira dem bin dey pay – FAAN tok.

Meanwhile international flight passengers including those wey dey come from Ecowas kontri go pay 100 dollars. Dis na huge increase from di 50 dollars wey dem bin dey pay before.

Di passenger service charge alias PSC dey mainly for di services wey di airport managers (FAAN) dey provide to passengers like water, toilet, air conditioned environment and security. Di PSC charge dey added into di ticket cost. FAAN tell BBC Pidgin say dem no dey collect cash from passengers for dis one.

Di reason why FAAN dey increase dis charge na becos overhead cost of operation don go up and e need moni to function.

Oga kpata-kpata for FAAN, Rabiu Yadudu wey announce di review to tori pipo for dia headquarters for Abuja, tell BBC Pidgin say dem don inform all di airlines.

Oga Rabiu wey ask Nigerians to bear wit di agency sake of how di kontri hard say di agency don lose 90 percent of im revenue.

‘5 September international flight resumption update’

FAAN say dem dey ready and don prepare well to make sure say evertin go well as di kontri resume international flight on di 5 of September, 2020.

Oga kpata-kpata for FAAN, Rabiu Yadudu say dem go improve on di already existing covid 19 protocol arrangement wey don bin dey airports.

E further explain say since dis travellers dey come from oda foreign kontris, dem go tight dia belt and follow di international health protocol.

Na di presidential taskforce on Covid 19 go hand dem over dis international protocol for dem to follow up, e add.

E say for now dem neva get signal as to which flight go land on Saturday but dem di sure sure say middle east kontris like Dubai don already give signal say dem ready for business.

Di FAAN oga wey announce di review to tori pipo for dia headquarters for Abuja, tell BBC Pidgin say dem don inform all di airlines.

Captain Yadudu explain say FAAN go use di moni to kontinu to maintain and upgrade facilities for Nigerian airports.

E further yarn give say goment don invest plenti to repair airports for di kontri and di 1000 naira charges no longer dey enough.

Meanwhile di Minister of Aviation, Senator Hadi Sirika don relocate to Enugu state following di plan to reopen di Akanu Ibiam International Airport on di 30th of August.

Di reason for im relocation na sake of say e wan monitor di work wey contractors dey do for di airport and make sure say e dey standard.

Di minister don assure indigbo dem say by Sunday dem go surely begin enjoy flight operations for di airport.

Di goment bin shutdown di Akanu Ibiam International Airport for 30 August 2019 sake of say di runway bin don spoil.Federal Airports Authority of Nigeria (FAAN) don increase passenger service charge by 100 percent.