Curfew: Nigerian States wey don declare curfew for #EndSARS protests

Some states Governors for Nigeria don declare alias impose curfew wey mean no movement inside states wia #EndSARS protests don cause kasala.

Di reason why state governors impose curfew say na because jaduga pipo alias hoodlums don hijack di [EndSARS] protest to begin cause confusion for dia states.

See Nigerian states wey impose curfew for #EndSARS protest

EndSARS protests

BBC

Lagos state

On Tuesday 20 October, 2020, Lagos State Govnor, Babajide Sanwo-Olu impose 24 hour curfew for all parts of Lagos starting from 4pm.

But e later come extend di curfew time to start by 9pm for pipo to fit reach dia houses sake of heavy traffic.

Di govnor say na because say jaduga pipo don hijack di peaceful End SARS protest to do evil across Lagos.

Oga Sanwo-Olu say na only essential workers and first responders go fit waka for road.

Osun State

Governor Adegboyega Oyetola impose 24-hour curfew for Osun State on Tuesday.

Di goment of State of Osun put statement wey tok say dem don observe wetin dem call di unfortunate dangerous dimension wey di #EndSARS protests don take across di kontri, particularly for south west States of Nigeria.

Governor Oyetola based on di mata, declare 24-hour curfew on all parts of Osun State from 11.59 pm, Tuesday, 20 October, until further notice.

Di Osun goment say di events of di last 48 hours don show clearly say di protests don dey hijack by criminals and hoodlums.

Abia state

Abia state Governor Okezie Ikpeazu also put 24-hour curfew for Aba and Umuahia from 6pm on Tuesday, 20 October, 2020 till further notice.

Di Govnor say dis na to make sure say di life and property of pipo inside di state dey safe.

According to di statement from Commissioner for Information, Abia State, John Okiyi Kalu, some hoodlums wey dem count pass 30 attack police officers on official duty around Azikiwe Road.

Dem kill one of di officers and also cari dia arms and ammunition but dem arrest one of di suspected attackers with gunshot injuries.

Edo State

On Monday 19 October 2020 Edo state goment declare 24-hour curfew for di state till further notice.

Di curfew take effect from 4:00pm dat day.

Di govnor say di decision become necessary inside wetin im call di face of disturbing incidents of vandalism and attacks on private individuals and institutions by jaguda pipo wey disguise as EndSARS protesters.

Dis one dey happun afta some ‘hoodlums ‘hijack di End Sars protest and begin cause serious tension for di state sotey dem go prison free some inmates.

EndSARS protests

BBC
Jos for north central Nigeria hot sotey jaguda begin attack innocent citizens in di name of EndSARS protests.

Plateau state

Plateau state Governor, Simon Lalong impose 24-hour curfew inside Jos South and Jos North Local Government Areas with effect from 8:00 pm today Tuesday, October 20, 2020 till further notice.

Di goment tok for statement say for di past few days, di #EndSARS protests wey begin peacefully don gradually enta bad situation wia hoodlums dey attack and molest innocent citizens wey dey go about dia normal businesses.

Dis development enta anoda level on Tuesday wen protests lead to di destruction of properties, cars and looting of business premises along di Ahmadu Bello way plus di burning of one place of worship along Gyero Road inside Bukuru.

In addition, three deaths na im dem don record.

Ondo State

Gov. Akeredolu impose 24 hours curfew in Ondo

Di way di violent trend of #EndSARS protests dey happun from neighbouring states in di Southwest, di Ondo State Govnor, Oluwarotimi Akeredolu, don direct 24 hours curfew inside di state till further notice.

Di curfew start by 12 midnight Tuesday breaking Wednesday.

Governor Akeredolu say certain elements don hijack di agitation wey originally bin mean to correct di plenti wrongs wey di operatives of di dissolve SARS chop accuse for.

Ekiti State

EndSARS protests wey jaguda pipo don hijack don make Governor Kayode Fayemi order 24 hour curfew for Ekiti State.

Di 24-hour curfew go affect all parts of di state fro south west Nigeria starting from 10.00 pm Tuesday 20 October, 2020.

Di goment of Ekiti State don observe wit growing concern how di #EndSARS protest, wey bin start as a peaceful protest against police brutality by youths inside Ekiti State, don dey hijacked by some hoodlums, according to statement dem release on Tuesday evening.

Imo State

Governor of Imo State, Hope Uzodimma say im don watch wetin im no like as attempt by by some angry pipo try to hijack wetin dey otherwise peaceful protest by di youths to unleash mayhem for di state.

Based on di mata, to ensure say di peace for Imo State (south eastern Nigeria) no dey disturbed, a 24 hour curfew na im di Govnor impose for state till further notice.

Dis one mean say no movement for di state either in di daytime or at night, except for those on approved essential services.

Di curfew na wit immediate from 12 midnight Tuesday 20 October, 2020.

Everione dey aware of di demands of di youths in different parts of di kontri; mainly for di scrapping of di special police unit known as SARS because of di alleged brutal tactics wey dem dey use deal wit members of di public. Govnor Uzodimma add.

Di govnor also ask for di reform of di police force and better conditions of service.

EndSARS Protests

BBC

Wetin dey happun for oda parts of Nigeria?

Tori be say anti-riot police unit of di Nigerian Police Force don collect marching order to immediately enta streets sake of violence for di #EndSARS protests.

Dis order wey land Tuesday afternoon from di kontri Inspector General of Police follow how di #Endsars peaceful protest wey youth for di kontri dey do to end police brutality from early October 2020 across Nigeria begin turn violent since dis week.